MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 1 October 2014

BETA PESIN! SAHEED OSUPA DON BUY LAND FOR ALL HIM BAND MEMBERS

SAHEED OSUPA
Fuji miuzishan and Glo Ambassador,Saheed Osupa,don define di meaning of good example veri well wit di good tin wey him do for all him band membas.
He show how oga dem sopose to dey lead by veri veri good example by aprishiating pipo wey dey work for dem as di Fuji star buy land for each and evribodi for him group.
He share di big plot of land wey he buy for Ota, Ogun State for di band Bois wey follow am stat dis miuzik hussle.

Dis kain tin hard to see as we pray make God touch di heart of oda miuzishans to follow dis wondaful example wey Saheed Osupa don set.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...