MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 29 October 2014

SIMON MBAM COMMIT SUICIDE BICOS OF N1, 000


No be small tin for Izzi local govment area for Ebonyi State as one Mr Simon Mbam kill imsef afta di kpokpo wey some villagers give di guy bicos of 1k wey im tiff from one woman shop.
Simon go buy drinks in di evening make im and im frends take coolu dia mind.
As he buy di shack dey chilax wit im bobos,naim di woman raise alarm say somebodi tiff 1K from di carton wey she dey kip moni.
Like pesin wey mess for church,evribodi wey come buy sontin for di woman shop dat moment deny say dem no take any moni.
Di villagers wey later carry di mata for head like lakpalakpa,give dem till di next day to return di moni back.

Like play like play,dem see di moni for di shop dormot di next day but di villagers and shop owner say 'who sai',say dem must know di pesin wey gbaskele di moni.
Simon Mbam later confess say naim tiff di moni and no be small beating di villagers givam as dem nearly sendam to early grave as dem beatam faint.
U know as village mata dey be now,dem say he must buy two goats,two carton of beer and 5K and simon mama no waste time as she provide dem.
But di ogakpatakpata for di village(di village head), say she must add 5K join to make am 10K and dis one kon make Simon weak for di way wey di mata kon dey go as di bobo escape from di villagers hand and jump enta Aku pond close to di market square.
Dem try to rescue Simon but he don alreadi kpeme bicos of di plenti water wey im shack for inside di pond.
Now di village head and four oda pipo wey get hand for Simon death don enta heavy gbege as police don open office for dia head.
Simon momsie naim go report for station imidiately her pikin die.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...