MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 14 October 2014

STEPHEN KESHI DON CHALLENGE NFF TO SACK AM


Super Eagles coach,Stephen Keshi, dey para siriosly as he don challenge NFF to sack am if dem like.
He say if dem sackam today today,im go get anoda job one time bicos im na profeshona coach.
He say some pipo dey gang up against am make im for fail.
He say he no go mention dia names but dem know dia sef.
He say na big shame say some pipo no want make naija qualifai for di Africa nations cup but make dem know say dem no be God.
Di forma Strasbourg of France player,Stephen Keshi also yarn say, some pipo ready to sell naija for 2 kobo. 
He say Super Eagles na naija own,no be Keshi getam,so if dem like make dem sackam anoda job dey wait am for anoda area.
One Nigeria football federation memba from di south south wey we follow yarn but he say make we no mention him name,yarn us say,sun tin dey worry Keshi for head bicos he no know wetin im dey talk.
He say dem dey givam plenti moni and free hand to do anytin wey him like wit di team but he dey find pipo wey im go drag dia name join im failure.
Super Eagles go play di return leg wit Sudan tomorow for di nations cup qualifai for Abuja afta dem lost di fest leg,one zero to di same Sudan for Khartoum on Saturday. 

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...