MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 8 October 2014

KPONMO CHOPPING IS DANGEROUS TO YOUR HEALTH-DR ISUWA ADAMU


Govment don dey do evritin to take convince pipo to stop di eating of kponmo as anoda pesin don come out dey draw naija pipo ear say,'Make una stop to chop kponmo'.
Dr Isuwa Adamu di Director General,Nigeria institute of Leather Science, NILEST,talk say kponmo chopping is veri dangerous bicos some of dis animal dey sick and dem don give dem injections bifor pipo dey kill dem to chop and sell.
He say if you chop dat kain kponmo wey di chemical for di injection still dey, naim be say na yorsef you dey kill sofri sofri be dat.
He say pipo no dey allow di injections and di chemical to do im work finish for di animals bodi bifor dem dey kill dem.
Dr Adamu yarn say apart from say kponmo no dey give anytin for bodi, some of dis animals get skin disease.

He say if you like make you boil di kponmo for 100 hours sef, some bacteria for di animal skin fit no die.
So wen you eat dat kain one naim be say na double wahala for dead bodi.
Dr Adamu say im go do evritin and im go kontiniu to preach till pipo go stop di chopping of kponmo.
He also advise govment to bring law wey go make pipo stop to chop kponmo as back up for meat.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...