MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 29 October 2014

AYIRI GIVE HIM SISTER 250K BICOS SHE COOK BETA EGUSI SOUP FORAM


Good soup dey make some pipo lick plate, good soup can make pesin bite im finger,good soup dey even make some men confess dia sins to dia wife.
Di tori now be say, di good Egusi soup wey Stella Emami cook for her sinior bros, Warri billionaire, Ayiri Emami, don land am beta moni.
Ayiri bless her wit two hundred and fifty K ( 250K) bicos she arrange beta soup wit plenti orishirishi and gwongwon for inside.

Stella naim yarn dis one for her instagram page and akordin to her she say, she hama dis raba from her bros hand bicos of di strong soup wey she arrange foram.
she say make baba God kontiniu to dey bless Ayiri always as he dey rememba dey do good foram.
Ayiri Emami just some few days ago, buy customized Asba Rollz Royce dash im wife for her birthday.
If u won cook koret egusi soup put for cooler or flask dey carry waka just in case u sight Ayiri and u want make he do bonanza for u too,
make i give u expo for wetin u go buy to prepia di koret Egusi soup:



  • grinded egusi(one cup or more)
  • stuck fish head
  • meat(goat meat, male, turkey, beef, chicken,camel, donkey, lion or assorted meat)
  • Onions
  • fresh leaf(Ugu)
  • 3 cubes of maggi
  • salt
  • dry fish
  • 2 ogiri or dawadawa
  • fresh pepper
  • .  red oil
    .  and any oda tin wey u won add join, no wahala.

    No comments:

    Post a Comment

    LinkWithin

    Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...