MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 13 October 2014

TY BELLO DON DELIVER TWO BOUNCING BABY BOYS


Afta 9 years of marriage, baba God don bless di marriage of Naija artiste,Ty Bello and Kashetu Bello wit twin bois.
She born dis 2 bouncing bobos for America on Saturday and dem don alreadi giv dem name.

One name na Christian and di oda one name na Christopher.
Ty Bello just reliz her third album wey she call "Morning song book"some few days ago bifor she born di twins.
Di miuzik wey she take announce her name for di industry na The land is green .
Ty "Toyin" Bello stat miuzik wit di group KUSH bifor evribodi kon waka go cane dia line.
Oda pipo wey dey dis band dat year na, Lara George,Emem Ema and Dapo Torimiro.
Na she also be di official photographer to President Ebele Goodluck Azikiwe Jonathan and also di official photographer for Thisday Lifestyle magazine .
Congratulations to Ty and her husband Kashetu.

1 comment:

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...