MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 6 October 2015

HOW I WON TAKE BROKE WEN E BE SAY NA Mi BE DI FIRST YORUBA ACTRESS TO STAY LEKKI PHASE 1-LIZ ANJORIN

Popular Yoruba actress,Liz Anjorin,don pour cold water for di tori wey dey town say beta alarm dey tearam and di alarm don make kam sell her cars,close her shop down and even sef,na kaikai (aka paraga or ogogoro ),naim she dey sell now.
Liz say na beta lie dat one be.
She say she neva borrow money once,she say she be big name,she say she dey live large and na Ikoyi she dey stay.
She also yarn say na she be di first Yoruba actress wey first rent haus for Lekki phase 1.
On top all dis one,Liz Anjorin say she get koret solid mottos.
She get Envogue,Chrysler and she say she also dey drive Xterra.
Di yellow pawpaw actress,also yarn say na di work of her enemies wey dey yarn labalaba about her just to bring her name down as she even tell dem say make dem go hug transfoma if dem dey jealous am.
Di one wey even make her vex pass,na di ogogoro wey dem say she dey sell now.
She say she nor get ogogoro shop,na clothes shop she get and di shop worth ova N80million.
Liz yarn say how ogogoro sella want take wear di kain clothes wey she dey wear?
She say nor be say she dey proud but make pipo respect demsef.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...