MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 30 October 2015

YOU GO SPEND ONE YEAR FOR PRISON IF YOU CIRCUMCISE ANY GIRL AGAIN-OGUN STATE GOVERNMENT


Mrs Elizabeth Sonubi
Di quickest way to spend one year now for Ogun State now,na to circumcise yor daughta.
Di comisiona for women affairs and development for Ogun State,Mrs Elizabeth Sonubi naim yarn dis one for Abeokuta for one join bodi conference to celebrate "16days activities to take remove women oppression kpatakpata".
Sonubi say di law against female circumcision for di state still dey kamkpe.
So diafor, if dem catch anybodi wey carry razor blade, Jack knife, dagger, cutlass or any sharp tools take near dat tin sake of say dem won comotam, na jail di pesin go find imsef for one year.

Di comisiona say female circumcision na harmful traditional practice for women and girls bodi.
She also yarn say Ogun state don put eye for ground to make sure dia is no more oppression against women.

Eliza say oppression no good at all at all and na dis one make dem don put forward and propose di Domestic Violence Prohibition Bill.
My Ogun State pipo,make una nor say I nor warn una o!

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...