MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 27 October 2015

SHARRAP DAVIDO!!! WHY U GO TALK SAY NA LIL KESH BE Di BEST NEW ARTISTE FOR 2015?-CYNTHIA MORGAN

Cynthia Morgan don tell Davido make he go siddon for one place,few days afta she tell tori pipo say, na Davido be one bobo wey be say, if dem giam chance,she go leak him ear.
Kasala don buss out bitwin dem two,four days afta she yarn say,among all di celibritis,na Davido she dey trip for pass.
Di hole wahala start wen Davido hand skratcham go write for twita say,na Lil Kesh go win di best new miuzishan for di Headies Awards wey go appun veri soon.
Akordin to Davido,he say na Lil Kesh be di MVP dis year make evri oda pesin chill for di boy wey sabi.
Quikquik mazamaza,naim Cynthia Morgan reply say,make Davido go siddon for wia containam bicos evribodi wey dia name appia for dat list na MVP.
Apart from di German Juice singa and Lil Kesh,oda artist wey di oganisers choose for dis award na,Reekado Banks,Kiss Daniel and Korede Bello.
Like follow come battery for phone,di next rated award go follow come wit brand new motor.
So anybodi wey win di award,go win di motor join.
Issorait,make I go prepia for di next tori.
Gudluck to all of dem.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...