MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 26 June 2014

SNAKES DON DEY KILL BOKO HARAM MEMBERS FOR SAMBISA FOREST


Wetin Nigeria army no fit do,na snakes kon dey do am.even kpakpa sef,wetin Amerika,Britico army and oda pipo wey dey hep Naija to find di Chibok skul gehs wey Boko Haram kidnap no fit do,snakes don dey do am.
Akordin to di tori wey we gada,snakes and bees don dey atack and bite Boko Haram membas for inside Sambisa Forest and some of dem don dey tear rase enta town kon hide.
Na some of dia membas wey di vigilante bobos,di 'civilian JTF' arrest for Mairi ward near Univasiti of Maiduguri,na dem make dis confeshon say spirichua snakes and bees dey use dem do shege and dem say anytime wey dis snakes bite dem,e no dey rich 24 hours di pesin must die.
Akordin to one of dem wey dem katch,Kolo Mustafa,e say if di snakes bite dem,dem go kon vanish like williewillie.
Dem say akordin to di tori wey dem hia for Sambisa forest,e be like say na Chibok pipo and di ghost of di pipo wey dem don kill,naim dey turn to snakes and bees dey show dem pepe.
For May last month,rumors enta town say,snake bite 2 of di chibok skul gehs and dem later die.
Akordin to Mustafa,some of dia lidas dey eskape enta Cameroon but dem wey to stay Maiduguri don masta,dem try to dodge enta di town back bicos na dia dem for born dem.
Dem say dem dodge enta Maiduguri for nite and kon hide for one uncompleted building.dem say e no take di 'civilian JTF'
2 seconds to arrest dem.
Dem say okpolo eye no bi open eye as di eyes of Boko Haram membas wey dem arrest don clear bicos now dem don dey beg in di name of Allah say make dem no kill dem,say,dem go repent.
Dem say na force dem force dem join Boko Haram  and dem know say na veri bad life dem dey liv and e no good at all.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...