MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 5 August 2016

AMERICA GOFMENT DON WARN DIA PIPO MAKE DEM NOR VISIT BORNO,BAYELSA AND 18 ODA STATES FOR NAIJA BICOS DEM NOR DEY SAFE


America gofment don warn dia pipo make dem dey kiafu about di places wey dem go visit if dem dey enta Nigeria.
America name 20 states wey dem see as 'no go area'.
Dem say dis states dey dangerous so make dem shine dia eyes welwell.
Borno,Adamawa,Delta,Edo,Rivers,Gombe,Imo,Niger,Plateau,Kano,Bayelsa and Yobe.
Oda states wey dia name appia for dis list na,Sokoto,Zamfara,Jigawa,Bauchi,Kebbi,Kogi,Katsina and Edo.
America make una go sidon wia kontain una.
If una nor know di diferens bitwin peaceful states and jaguda states,make una talk.
Una kontri and naija wich one dey safe pass sef?
If nor be small tin Osama for bomb my broda join world trade senta for New York for 2001.



No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...