MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 6 August 2016

FUNNY ACTOR CHARLES AWURUM,DON YARN SAY,HIM GIRL FRIEND MAMA CANCEL DIA MARRIAGE PLANS BICOS HE NOR BUY GENERATOR FOR DEM


Funny and mumu Nollywood actor,Charles Awurum,don yarn Tori pipo say,her forma babe mama play wicked role for dia relashonship wey krash like pack of cards.
Di funny man say,'i beta pass my neighbour generator' wey him nor buy for dem,naim make di babe mama hate am.
Dem don fix di date for di tradishona wedding finish bifor di mama telam say di union nor go work.
Di whole gbege akordin to Awurum start wen he go visit hin babe for dia house.
Dat piriod him stil dey stay one room for Enugu.
He say as he rish dia house,NEPA don alreadi seize dia light.
Mouth kon go skratcham ask dem say,why dem dey darkness?
Naim di babe mama rush telam say "make he buy dem generator".
He kon use joke tell di mama say,"di pesin wey u want make he buy una generator so,u don askam weda hin get generator"?
Charles Awurum say since dat day,di mama nor wan use eye siam.
Di mata kon rish one level,naim dem vex carry di babe go Lagos just to diskonet dem.
Afta evritin,two of dem later jam for Lagos again and na dis time dem fix date for di tradishona tins.
Bifor u go say,siddon look na dog name,di mama don para say di marage nor go work.
Di exkiuz dis time be say,famili say dia daughta must marry pesin wey come from dia village.
Awurum say wetin pain am pass be say,di babe kon dey soport di mama.
Di bobo say na so dem take brake hin heart for ground o.
He look up,he look down,naim he vex enta fasting and prayers and God nor waste time to ansa ram.
Jobs come,scripts come,plenti mumu roles wit Mr Ibu come,money come,evritin double double,come.
Today now,God don givam a veri biutifu wife wey hin meet for church and dem don get three strong boys for dia union.
Nor be only dat one o.
He dey stay beta house now,he dey live beta life.
Afta he marry,he say di forma babe kon stil carry her two left leg comeback but by den,water don alreadi pass garri.
Fear God.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...