MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 3 August 2016

PASTOR ADEBOYE DON ADVICE BOBOS SAY,BIFOR MARRIAGE,IF YOUR WOMAN NOR SABi COOK CORRECT WACK,MAKE YOU GIVAM CHANCE


Baba don yarn o.
Di General Ovasiar of Di Redeemed Christian Church of God (RCCG),Pastor Enoch Adeboye,don yarn naija young bobos wey neva marry say,make dem shine dia eyes wella bifor dem put woman for house.
Baba say,if di woman nor sabi cook,if she nor fit pray for one hour,if di babe lazy,make you run for yor dear life.
He say make you take dis advice veri sirios bicos some pipo wey nor follow hin advice bifor,don dey comeback for prayers.
He also warn bobos make dem run from babes wey dey dance azonto,shakitibobo and Skelewu and babe wey dey club all night and oda nyama-nyama tins.
As he talk am, " nor marry girl wey dey worldly" bicos u go regretam.
Nor be only di boys Adeboye advice o,as he also advice gehs make dem nor marry man wey nor dey work to avoid storis dat touch.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...