MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 17 July 2014

OJUJU CALABAR DON CAUSE DI DEATH OF ONE 5 MONTHS OLD PIKIN.


 
 No be small tin o,as one masquarade don cause di death of one pikin for  Amakohia Ubi, Owerri West Local Government Area of Imo State.

As di masqurade dey pursue one 10 years old geh wey carry di pikin,she kon run enta backyard but eye of fear,naim di geh trow di 5 monts old pikin for inside 'mama put' pot of soup.
Akordin to Chika,one woman wey see evrytin as e take hapun,she say as di ojuju man see say di pikin don draw for di geh hand enta put of soup,naim e take yawa race.even di geh wey carry di pikin,fall yakata for near fire and na smol tin remain fire for roast her like corn and ube.
Although sha,di villagers try to reskiu di pikin but as dem rusham rich hospito,dokita kon tell dem say di baby don already kpeme.


Oru festiva naim be di name of di festiva wey di masquarade dem dey dance and na normal festiva wey dem take dey jolificate for dia kolchor b4 im go turnam to anoda tin.even di vilagers dey sorprise as dis masquarades don ton Oru or Okorosha festiva as dem also dey call am,to robish festiva.dia own na to dey use charms and otumorkpor wen time don rich to celibrate and dis masqurades eyes dey chuk like chukuchuku as dem no dey use eye see babe.

Di shock neva stil comot for di pikin mama and papa bodi as dem stil dey cry say dia onli pikin just die like dat.many pipo wey dis mata toch dia spirit don dey visit dem and giv dem heart to bear di loss.

All di hole efort wey tori pipo make to hia from di town union president and di tradishona ruler,Eze Smart Eze for dis ting wey hapun for dia town,hit rock as dem no fit get dem to yan for dis mata.
Meanwhy,dem don suspend di Oru festiva wey suppose last for one month bicos of dis sad tori wey hapun for Amakohia Ubi.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...