MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 31 May 2014

BOKO HARAM DON DEY THIEF VILLAGERS FOOD AS DIA FOOD DON FINISH FOR BUSH.





Report wey dey rich us bi say hunga don dey blow Boko Haram membas as dem don dey come out from bush to town come tiff food.
Dem don kill all di antelope,all di monkey,all di animals for Sambisa forest chop finish and now dem don dey enta town to tiff pipo meat,rice,beans,kpomo,tomatos,bread and even gala wit force.
Even kpakpa sef,Last Sunday,Boko Haram block one bus wey carry bread,kill di driver and di motto boys and dem kon drive di bus face Sambisa Forest.di motto dey come from Gwoza and e dey go Polka but dem kon waylay dem for Wallaba village,kill dem and take di motto.
Tori wey our Tori team gada be say,di food wey dem get nor dey rich dem eat not to tok of di one wey di ova 180 gehs wey dem kidnap go chop.na since April 14 dem kidnap di gehs dem from dia skul for Chibok and Naija army don dey look for di gehs but dem neva stil see were Boko Haram hide dem.oda countries wey join bodi to find dis gehs na,America,Britain,France and Britain.
Akkordin to some of di villagers wey dey stay wia Boko Haram dey go tiff food,dem say,if u see di kain red eye wey dem take dey pack all dia food,somtin go tell u say,e be like say dem won use some of di food take feed di gehs.
But di bad tin be say,akkordin to one man wey dey stay Kamuyya village,afta dem don tiff food and malu finish,instead make dem carry dia wahala go jejeje,na lie!
Dem go kon dey kill pipo,dem go burn down dia shops,burn down dia motto and burn down dia house.
Some of di villa wey Boko Haram dey go tiff food na Limankara, kirenowa,Kamuyya, Kirenowa, Kimba,Makor.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...