MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 16 May 2014

BOMB BLAST FEAR DON CATCH TRADERS FOR BALOGUN MARKET.



Nor bi small yawa race naim shele for around di centra mosk for Nnamdi Azikiwe strit and Tinubu square for Balogun market yesterday as one man wey just dash beggars moni raze alarm say him see one tin wey be like bomb for front of one compini yard for di area.
Nor bi smol tin o,as pipo come dey col dia frends,col dia family say make dem no near dat area for any bizness bicos of di bomb rumor.
Na policemen for bomb mata wey rush come there kon kam di pipo down say make dem no fear say no be bomb di tin be.di bomb expats say di tin na wetin dem take dey patch bodi of ship wey dey leak or ship wey hin bodi don rost.
The pesin wey lead police for dis tok tok na Ngozi Braide.he say di tin no bi bomb at all say wey dem testam,so make dem relax dia mind.Ngozi Braide kon praise di area pipo say dia teeth complete and dem too mosh bicos dem put dia eye for ground to make shor bad bad tins no hapun for dia area.
Too many bomb blast don hapun for Naija for ova 4 years now.di last one na di Nyanya bomb blast for Abuja wey kill ova 77 pipo for garage.
Repot wey dey rich us be say dem don arrest one of di bobo wey plan di bomb attak for Nyanya garage.
Him name na Aminu Sadiq Ogwuche.Na for Sudan dem arrestam and federa govment don dey wok on di paypas make dem fit sendam back to Nigeria to answa him papa name.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...