MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 26 May 2014

TWO REAL MADRID FANS DON DIE FOR LAGOS.



Two Real Madrid fans don kpeme for Lagos on saturday nait bicos say Real Madrid no quik equalize di goal wey Athletico Madrid score dem for di Champions Lig final wey shele for Lisbon,Portugal.No bi di fest time wey dis kin tin dey hapun be dis.some men don throw dia wife down from upstair bicos dia team lose mash,some don stab dia frends die bicos of mash,some even kpakpa sef don comit susaid bicos dia clob wey dem dey suport no win mash.
Baba God for Heaven go dey wonda sef say,why pipo kon take futbol mata sirios like dis!
For dat nite wey dose 2 bobo die,Athletico fil say dem don win di mash finish ontil Real Madrid kon skor and equalize for di last minit.Madrid kon still skor anoda 3 gols to put sansan for Athletico Madrid garri.di bad ting bi say dem no even dey alife to no weda dia clob later win di mash.
Di 2 men names wey die na Mista Olusoga Ogunbanjo.im na 39 years and na fridge he dey repair.di oda man name na Mista Bambo Sholeye wey dey work wit LAWMA and na 42 years old.di 2 of dem na Lagos Island dem dey stay.
Akkordin to tori wey we gada,Olusoga go one salun for im area go shave im biabia and kon use di oportuniti to wash di mash.e no too tey naim d guy faint as Madrid dey play sanya like say dem be 11 pregnant women.di bobo wey get di salun,Danku tok say dem rush am go Genera hospito and na dia im for die.di oda man,Sholeye,vex comot for wia im dey wash di mash as e no fit bear di kind futbol wey im club dey play as dem dey strawgo to equalize.na front of im house wey he sidon dey complain about di mash,na dia im faint b4 dem rusham go hospito.doctors try dia best to tritam but dem say im don already kpeme.
Di bad tin bi say,dis 2 men no dey alife to join Real Madrid celibrate and jolificate as evritin kon turn around and Madrid kon later win di mash 4-1 for xtra time.










No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...