MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 28 May 2014

NAIJA SOJAS SAY DEM DON LOCATE Di KIDNAP CHIBOK SKUL GEHS



Di Ogakpatakpata 4 securiti mata for Naija,Air Chief Marshal Alex Badeh,tok say dem don see di place wia dem hide di Chibok skul gehs wey Boko Haram kidnap.he tok dis one wen he dey kul di mind of di crowd down wey carry protest come he office.he say na sense dem take dey katch monkey,so diafor, Naija sojas nor go use force to free di gehs make e no go kos big wahala sake of say,if dem use force,di gehs dem fit die since Boko Haram don alreadi soranda di gehs dem wit bigbig guns and dangerous wipons.
Dis tori,go giv di gehs dem mama and papa smol hope but Chief Badeh say dem nor go fit tell anybodi wia di gehs dem dey for now since na di sikrit wey dem go take kontiniu to dey work and look for di gehs.
Tori wey our tori team also gada be say,President Goodluck Jonathan don cancel di plan wit Boko Haram to free di gehs.di plan b4 bi say,federa govment sopose to free about 100 Boko Haram membas wey dey prison,den,Boko go come free di Chibok skul gehs.but Jona phone from France wia he go do one join bodi meeting wit im felow ogakpatakpata from oda kontris about dis Boko Haram wahala,say,make dem put fulstop to dat deal.
Di rizin bi say,if dem do dis kain bizness wit Boko Haram,e go giv dem high spirit to kontiniu di kidnaping,di killing and do more wickedwicked tins.
Di konclushon now bi say,since Naija sojas no won use force, federa govment don deside to borow sense from all di monkey for inside bush,make dem use am take free and #BRINGBACKOURGEHS.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...