MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 22 May 2014

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA

POLICE DON ARREST DIPLOMATIC OPJ BICOS E PISS FOR GUTTA



Ekelebe don arrest Opute Pius Junior A.K.A 'Diplomatic OPJ' of wazobia fm bicos say im piss for gutta for marwa bustop for Lekki,Lagos.Wazobia Fm na one veri popula radio stashon for Naija.di guy bin show im muscle smol as e take police men time to fit arrest am and di mata kon cause heavy go slow for lekki Epe espressway.
The policeman wey carry di mata for head,Sajent Daniel Ighodalo,tok say na offence for Envaromenta sanitashon law of Lagos to bring out your John Thomas for public and piss for anywia u like.
Di mata dey court now as we dey tok and na 2 offence dem say he comit.nomba one bi say he piss for gutta and nomba 2,he show im muscle and power to police say im na boxer.
As dem carry OPJ go Tinubu jojment court for Lagos,di lawya wey joj di mata,Missis Olaitan Ajayi,gree make dem bail OPJ wit 20,000 naira and dem also make sure say im bring pesin wey sign shortee foram and stand for di case wey go continue on di 18 of june,2014.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...