MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 4 March 2015

I GO RESIGN IF NFA EMPLOY KESHI-PAUL BASSEY


E be like say di tin wey dey delay di Nigeria Football Federation,NFF from announcing Stephen Keshi as Super Eagles coach go still continiu if NFF take wetin dia memba Paul Bassey yarn yestaday,sirios.
Memba of di NFF technical Commiti,Paul Bassey don yarn say im go resign if NFF appoint Keshi as Eagles coach.
Bassey say di tin dey buss im brain and e dey pain am reach im bone say dem still dey discuss weda to renew Keshi contract or not.
He say di day wey im hear say NFF announce Keshi name as Naija coach,na dat day im go resign.
He also yarn say him don work wit Keshi for good four years and he don find out say di coach nor get anytin new to offer us again. 
Paul Bassey say di illa,Delta State born coach na legend for our football but if na for coach mata,Keshi no biam at all bicos akordin toram,di big boss know wia im coaching skills end but he dey form like say he sabi welwell.
He say we need new coach wey go bring fresh tactics and fresh tins enta di mata so make Keshi go siddon one place.
Stephen Keshi contract end last year and NFF kon sackam afta Super Eagles win Sudan 3-1 for Abuja for one nations cup qualifier but President Goodluck Jonathan say make dem call am back to handle di remaining matches and yet him no fit qualify Naija for di nations cup wey just end for Equitorial Guinea as na only draw instead of win naim dem play against di Bafana Bafana of South Africa.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...