MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 14 January 2015

PRESIDENT GOODLUCK JONATHAN DON SIGN ORITSEFEMI


Mercies of di Lord neva still stop to dey come down on di Delta born bobo, Oritsefemi as President Jona don vex sign am as di official musician wey go dey follow am go anywhere wey him dey carry campaign enter.
During di president campaign for tafawa balewa square for Lagos for next month election, Oritsefemi scata evriwia wit im performance as even oga Jona stand up and join evribodi dey sing along to double wahala, di music wey don catapult Oritsefemi name enta evri area and evri kona for naija.
No be small tin as Jona and di crowd turn "double wahala for dead bodi" to national anthem for di ground.
Ol boy! Evriwia stand still for Oritsefemi as di crowd dey shout say dem want more but di time no kon dey enof since dem go do oda tins.
Wetin kon plate Oga Jona dada welwell na wen Oritsefemi kon sing "Great jonathan"di music wey im compose for di president.
Di president no fit bear di happiness, naim he alla say Oritsefemi must to dey follow am enta evriwia for all him join bodi waka to kontiniu as di president of Nigeria.
He say Oritsefemi teeth complete and he also yarn say di bobo na great musician.
Oritsefemi go dey di next campaign ground for Akure dis week to kontiniu from were he stop.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...