MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 5 January 2015

WE NEED DIS KAIN THICK PLAYERS FOR SUPER EAGLES TO SCARE DIA ENEMIES?

HE NAME NA DANNY SHITTU and HE GO BREAK YOUR BLOODY KNEE
TROWAY FOR NOTHING
Dia names na Danny Shittu and Adebayo Akinfenwa.
Dem be naija born and na dem be di two biggest and thickest players for England right now.
Danny Shittu of Millwall football club, na forma Eagles defender why Akinfenwa wey dey play for Afc Wimbledon,  neva play for naija bifor.
I rememba wen Cameroon dey suffer Super Eagles wit dia thick thick players.I rememba wen Mboma dem dey use big big bodi dey push dem Celestine Babayaro comot for road go score us goals and win plenti nations cup for our head.
In short, since Cameroon stop to use unripe plantain players, dia football don go down like tire wey nail chook.
So you feel say di Super Eagles of naija wey evribodi dey beat nowadays need Rugby muscle players like Danny Shittu and Adebayo Akinfenwa for our squad to put fear for other kontris mind?
Or you feel dia muscle na wash, say notin dey appun?






No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...