MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 3 March 2016

SENATOR DINO MELAYE,DON YAB OSHIOMOLE SAY MAKE WE STOP TO PAY DOWRY WIT POUNDS AND DOLLARS ON FOREIGN GIRLS


Dino Melaye,one of di Senator wey also like to dey yarn een mind,don use brain yab Edo state gofnor,Adams Oshiomole,say make we dey enkorrage made in naija women instead of to dey pay dowry in pounds and dollars.
He say e gud say make we dey buy made in naija goods and products and also to dey marry made in naija babes make our market for dey sell.
Dino Melaye

Dino yarn all dis one inside di senate floor on top di joinbodi talk wey Senator Eyinnaya Abaribe bring up for diskorshon.
He say him hapi for dis tori wey di made in Nigeria Senator Eyinnaya Abaribe bring come,so diafor,we must do evritin posibo to soport our tins.
If u rememba last year,Oshiomole marry one biutifu yellow peperenpe,Lara Forte wey him import enta naija from Cape Verde.
Inshot,no Gofnor wife fine rish dat malawi for dis kontri.
We dey wait to hia Adams Oshiomole reply to Dino Melaye,di senator wey dey reprezent Kogi  West.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...