MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 14 March 2016

DNA TEST DON SHOW SAY NA SOLIDSTAR BE DI ORIGINAL PAPA OF HIM OYIBO PIKIN


Na wa for tori sha.
If yor woman or geh frend nor be wakajugbo,wetin go make una do DNA test?
Abi sombori don also dey claim Solidstar pikin wit een oyibo geh frend?
Di gud news for di miuzik star,'Solidstar' be say,afta di test,di result confam true true say naim be di original papa of di pikin wey one oyibo babe for Britain born foram.
Solidstar naim use een hand show us di result and he write on top di result say,"all di pipo wey dey yarn nonsense,dis DNA result go make dem shut up dia gutter mouth.
Ha!shuo!
Thank God say I nor dey among o!

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...