MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 8 March 2016

SEE OPPRESSION: POLICE DON ARREST 14 GOATS FOR OSUN STATE AFTA DIA DRIVER RUN LIVE DEM

Nobody know why di driva of one red Mitsubishi car for Sekona johnshon wit plate nomba XF 467 NND,run live him car and tear yawa race afta police porshoe am.
Inside di car,police diskova say di driva carry 14 goats for Ede,Osun state.

Some policemen wey dey patrol Sekona/Nigeria Army regiment construction kompini highway around 1am,see one red car wey dey tia speed,naim dem telam make e stop.
Who sai!di driva putam for gear3.
Di patrol team porshoe am rish Sekona junction to cementery area for Edun-Abon bifor di driva park di car and take yawa race.
As I dey talk to u like dis,police don arrest di innosent goats put for cell.
Right now,di goats brodas don dey para as dem don enta town go look for lawya wey go hep dem porshoe di case for court.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...