MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 1 March 2016

JESU! PASTOR OF CHRIST MIRACLE CHURCH,AJEBAMIDELE,ILE-IFE, DON SNATCH CHURCH MEMBA WIFE FOR OSUN STATE


Wetin dis world dey turn to?
One local court for Ile-Ife,Osun state, don agree to di demand wey one Olusola carry come to put full stop him and een wife marage.
Di court don skata di 10 year old mariage of wood seller, Olusola Onifade and een wife,Simbiatu wen di man yarn court say dia pastor,Femi Olayinka don snatch een wife fromam.
He say di pastor even tretinam say he go killam if he nor live di woman.
He say him na figure head bicos di pastor naim dey in charge of een wife.
Olusola tell di court say,di day wey een fear een head na wen di pastor telam say he don already dey sleep wit een wife and naim giam di belle wey she carry right now,so if he won still live,make he give di woman chance.
Olusola say een dey he own jeje wey sombodi convinsam to atend Pastor Femi chuch,Christ Miracle Church,Orisun-Iye,Powerline,Ajebamidele,Ile-Ife,Osun state.
Di woman wey dey centre of dis kasala,Simbiatu yarn say,yes na true and she kon tell di court say she want her hosband again as she don fall in love wit Pastor Femi.
Afta di president of di court,Chief Bunmi Adegoke hear all dia storis,he kanso di marage and say na Olusola go take kia of dia two shidren.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...