MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday 3 March 2016

UNBILIVABLE!!! LION,BEAR AND TIGER TURN SIRIOS BRODAS FOR ZOO AFTA 15 YEARS TOGEDA


Dem say wot God has join togeda,let no man put asunda.
E hard to see lion wey get frend, just di way e hard to see Ijaw man wey nor sabi swim.
But for di Noah's Ark Zoo for Georgia,one lion,tiger and bear don turn frends.
Three of dem dey eat togeda,play and sleep togeda and den don even nickname dem,BLT.
Dia bonding don strong so tay,three of dem dey join bodi togeda to snap pishor.
Dis na animals wey hunga won kill for Atlanta,USA and police see dem afta dem raid one area wey bad boys wit drugs dey.
Dem see di animals during dia raiding and dem kon carry dem go di zoo for Georgia,for inside America.

Since dat time dia levels don change as dem don turn brodas for life.
Even di zookipa sef dey soprise for dia frendship.
If dis animals wey like to dey chop demsef as food fit turn brodas,why we nor fit live togeda as one?
Hausa man dey fight Igbo man,Igbo man nor won see Yoruba man.
Ijaw dey fight Itsekiri,Itsekiri dey fight Urhobo.
I hope say afta u read dis animals tori,we sef go bigin love and live togeda like dis animals.
One love my pipo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...