MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 4 March 2016

TROUBLE DON WAKE YANGA WEY DEY SLEEP,AS DELTA UNIVASITI DON ARREST ONE GUY MAN WEY ENTA HALL GO WRITE EXAM FOR HIM BABE


E nor gud make pesin be olodo at all o.
Dis kain tin go only appun wen yor vilage winch dem dey use torch and candle dey monitor yor progress.
Examination monitoring group and lechoras don katch one Inneh Aisosa of di Federa Univasiti of Petroleum Resources,Effurun,Warri,for inside hall as he dey write exam for een babe,Onakpoma Oghenetega,400 level student of Delta State Univasiti,Abraka(Delsu).
Instead of dis guy to pray make Baba God ansa een call one day,een kon go smart ansa kirikiri prison call.
If Inneh Aisosa,di bobo wey dem catch dey write exam for een babe nor enta prison,e go be di biggest soprise of di century.
Nor be say I dey pray make dem jailam o,but di weight of di ofence too heavi.
Dat time wey we dey akara skul,dem dey always dey warn us say,if dem catch u dey do expo,gofment go jail u for 21years.
If he eskape prison,make he tank een God.
Dats why e nor gud to folow devil drink tea ova nite.
See di big wahala wey di babe and devil don put dis bobo bicos of love.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...