MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday 16 March 2016

CHOi! CHECK OUT GURU MAHARAJI DRESSING TO OONI OF IFE WEDDING TO WURA (fotos)


If u dey di ground wia Ooni of Ife and Wuraola for do dia wedding last wikend,if Guru Maharaji dressing nor soprise you,naim be say notin fit soprise you again for dis life.
Di spiritual lida imsef, Sat Guru Maharaji,wear flower full all him bodi enta di wedding.
Well,I know say di naija gehs wey dey di wedding venue go like di dressing bicos naija gehs dey die for flowers nowadays.
Bifor bifor, no naija geh won see her boyfrend wit rose flower or birthday card except beta gift or plenti money.
But now all dose tins don change as telemundo and bestsellas don hep us re-arrange naija babes mind.
Anyway,See more fotos of Guru Maharaji aka Black Jesus to di wedding for bottom hia....



No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...