MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Friday 11 March 2016

AFTER 7 MONTHS,PSQUARE AND SOUNDCITY DON FINALLY SETTLE DIA GBEGE



Since Septemba last year,Psquare and miuzik tv station,Soundcity,nor dey agree wit each oda.
Peter naim first cry out say,Soundcity don stop to play dia miuzik.
E no take Soundcity time bifor dem reply dem.
Dem say na Psquare first show dia kpai nomba as dem dimand for big money wen dem do one show.
Soundcity agiument be say,dem don hep Psquare dey play dia jams since dis group start and now dem dey ask of big money from dem like say tomorow nor dey.
Dia sinior broda and manager Jude,yarn dat time say,wetin Soundcity don do for Psquare?
Dawon kon vex Soundcity as dem stop to play dia miuzik.
But now,Paul di oda half of Psquare don carry waka go mit dem and dem don setle di kasala once and forall as di bobo postam on top intanet say e beta make peace reign.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...