MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday 13 March 2016

WHY NOW? SEE DI FOTO OF DI BOY WEY COMIT SUICIDE BICOS HE FAIL JAMB


Di rizin why dis boy kill imsef naim I nor undastand.
Abi,all im frends pass and na only him fail?
Plenti pipo wey don pass jamb and later graduate,some of dem neva stil get job.
Some of dem dey even dey kip dia satifikate for kona and find one handwork Len.
Dis bobos wey u dey see for dis foto so,comit suicide just bicos he fail jamb.
Bicos Jamb cut off Mark na 180 and di boy score 159,naim make am kill imsef for notin.
And dis na di first time wey di bobo write jamb.
Instead of am to kam down,read welwell and try again next year,he just kill imsef like dat.
Well,anywia he dey now,weda na Heaven or hell fire,I wisham luck.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...