MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 7 March 2016

RADIO GIRL,TOKE MAKINWA DON CLEAR BOYS SAY, "NOR FEAR MY MAKE UP,MAKE UNA TOAST ME BICOS I DEY SINGLE"


Afta her marriage crash like pack of card,radio babe and Mrs social,oh sorry! Miss social,don comot shame for eye dey alla say make men stop to see her run bicos she don drop di Mrs for her name.
She nor fit bear di mata again now she dey shout on top instagram say 'I dey single Ooooooo! I need bobos Ooooo!
I nor dey soprise afta her hosband,Maje Ayinda, do touchingbodi and give him longtime geh frend belle.
Afta 9months,di babe born one bouncing baby boy pikin and nobodi tell Toke say,dia is fire on di mountain..run,run,run.run!
So boys,anywia una see Toke Makinwa,nor fear her make up,make una gada liver call her say,Hello Bae,my love for u is like bread and butter.
Na first come,first serve.
Make una nor say I nor tell una Ooo.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...