MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday 14 March 2016

TB JOSHUA NA FAKE PASTOR AKORDIN TO MALAWI PRESIDENT,PETER MUTHARIKA

O boy ye!
E be like say Malawi president,Peter Mutharika dey para beta para for Pastor T.B Joshua o.
If u be T.B Joshua frend or church memba,telam make he nor waka pass wia di Malawi president dey o,bicos dat guy fit dagaram wit knife.

Mutharika yarn for Tv for Malawi capita,Lilongwe during one rally say him hear say T.b Joshua yarn say him and Zimbabwe presido,Robert Mugabe go die bifor april.
Di president say Joshua don dive ground bicos een profesi nor go work.
He say dis one nor be 2012 wey T.b Joshua see profesi say one president go die for one  South Africa kontri and true true di forma presido of Malawi,Bingu wa Mutharika wey be di sinior broda to Peter Mutharika, die for 2012.

As Tb Joshua take yarnam,na so e take appun and naim make Malawi pipo dey take di synagogue pastor profesi sirios.
Di president say if Tb Joshua nor be fake pastor,he for see profesi say him building go kolaps for Septemba,2014.
Na 116 pipo die wen one of di building kolaps for Synagogue church of all nations and na pastor Tb Joshua be di owna.
Dat mata of di kolaps building stil dey court.
Make we dey watch weda Tb Joshua go ansa ram.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...