MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 5 March 2016

AFTA DAVIDO SIGN MAYOKUN,BOYS DON GADA FOR HIM GATE FOR LEKKI DEY SING AND BEGAM MAKE HE SIGN DEM TOO


Try yor luck nor be curse o.
If bread sella wey nor sabi speak one single inglish,fit get luck and turn millionia ova nite,who say yor luck nor dey some wia dey wait u?
Afta Davido sign Mayokun yestaday to HKN gang,some bobos don go try dia luck as dem gada for Davido gate for een Lekki haus dey sing make Davido try sign dem too.
As dem dey sing dia throat won tear,Davido sef waka near di gate dey tell dem make dem dey sing dia miuzik loud welwell wit siriosness if dem want make he sign dem.
My broda,anytin kan appun for dis life wey we dey.
As dem go back haus,dem go dey hope and pray say make Davido announce good news about dia mata.
Dis one pass intaviu wey pesin dey wait for result o.
Goodluck to dis pikins.


No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...