MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday 15 March 2016

RATS AND COAKROACH TOO PLENTI FOR MY HOUSE NAIM MAKE MY WIFE RUN FOR 3 DAYS - AY


Di kasala wey tori pipo report some weeks ago,say comedian Ay wife don cut out livam,don take anoda twist.
Afta di gbege,Ay and een wife Mabel don say notin dey appun as dem don yarn us say dia love stil dey strong kakaraka.
E be like say Ay neva dey satisfy for di explanation as he don give us anoda rizin why een wife comot for haus for 3days.
He say na bicos rat,kockroach,ants,don too full dia haus and dem kon spray evriwia to kill all of dem.
Dis kain action naim oyibo dey call fumigation.
He say na dis one make Mabel comot for haus go stay somwia else so dat di kemical nor go choke her die.
Ay say him dey soprise say popular tori woman Stella Dimoko korkus wey carry di mata for head like lakpalakpa just enta town bigin yarn pwan witout she nor find out wetin dey.
Ay also yarn say him go stay di marage foreva and him go love him wife till him go kpai.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...