MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday 12 March 2016

COMEDIANS DEY GET BETA PAY PASS ACTORS AKORDIN TO COMEDIAN,USHBEBE


Comedian and radio prezenta,Ushbebebe,don yarn say,di pay wey actors and actresses dey resiv,na chicken change compared to di pay wey comedians dey get for one show.
He yarn dis one wen he invov for one joinbodi intaviu wit punch.
He say di only tin wey him nor fit do na to dey act film bicos if he stay one place for too long,bodi go dey peperam and naim make am jejeje stick to een comedy.
Ushbebe say if u even lookam well sef,na kobokobo,actors dey kolet and dat one nor rish to take see front.
He say di day wey dem go start to arange dem beta pay,na dat time he go join dem dey act di film.
Di bobos dey throw one ogbonge show,Di Chronicles of Ushbebe' dis wikend for Muson centa,Onikan,Lagos.

No comments:

Post a Comment

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...