Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Monday, 24 June 2019
VICE PRESIDO YEMI OSINBAJO DON YARN TORi PIPO SAY,DIA IS NO WAY NAIJA NO GO BETA BICOS NAIJA PIPO NO DEY LAZY,DEM DEY VERY HARDWORKING
Vice Presido Yemi Osinbajo wey dey on a 4 day visit to America go see dia own Vice Presido Mr Mike Pence,don yarn tori pipo say,dia is no way wey tings no go beta for Naija as a kontri onto say Nigerians dey veri veri hardworking.
Dis na opposite of wetin Presido Muhammad's Buhari yarn about Naija pipo.
If you sabi rememba tings,Oga Buhari yarn say Naija youths dey lazy wen he visit London last year April.
Sunday, 26 May 2019
FOR EBONYI,ONE MAN DON PUT FUEL FOR BODY BURN HIMSELF ONTO SAY HIM NO FIT DEY FEED IMSEF AGAIN
Dem don rush one man go hospital for tritment afta he turn fuel for bodi and light matches take burn imsef onto say pepper no rest and to feed imsef na big ploblem toram.
Dis one appun for corner of one classroom block for Saint Patrick's Primary School Kpirikpiri Abakaliki,Ebonyi state.
Bifor dat day dem say he don dey complain give him neighbors say life don tire ram since even to see bread and beans chop don turn World Cup.
Di way wey pipo take dey frustrate for dis kontri nawadays don dey pass be kiafu abeg make gofment dey play dia part if not,pipo go kontiniu to read different meaning to democracy o!
Monday, 22 April 2019
COMEDIAN 'ZELENSKY' DON WIN ELECTION TO BECOME PRESIDENT OF EASTERN EUROPE COUNTRY WEY HIN NAME NA 'UKRAINE'
Di jokers kominiti around di world don dey selibrate dia fellow comedian 'Zelensky' afta dem declare am as di winna of Ukraine presidential election.
Volodymyr Zelensky difit di current president Petro Poroshenko wey also kip pride for one corner and congratulate Zelensky.
Bifor di election, Comedian Zelensky na also film maker and we hope say he no go take him new position take joke.
Saturday, 20 April 2019
DEM DON CANCEL THE JUNE 1st FIGHT BITWIN NAIJA BADDEST BOXER ANTHONY JOSHUA AND JARELL MILLER AFTA DEM FIND OUT SAY MILLER DON PACK DRUGS FULL HIM SYSTEM BIFOR Di FIGHT
If you be boxing fan and you dey follow up,you go don know say Naija baddest fighter Anthony Joshua fight wit American Jarell Miller suppose take place on di 1st of June 2019.
As you dey read dis tori like dis,dem don cancel di fight afta dem find out say Jarell Miller don swallow drugs wey fit givam killa punch full him bodi bifor di fight.
Anthony Joshua promoter Eddie Hearn don yarn now say,dem go find anoda challenger wey go fight di Naija killa puncha.
Tuesday, 16 April 2019
ONE PASTOR 'PASTOR GIWA' DON YARN SAY MAKE WE STOP TO PRAY FOR DEAD PIPO BICOS E NO MAKE SENSE, INSTEAD,MAKE WE DEY PRAY FOR PIPO WEY DEY ALIVE
Pastor Giwa of di 'Awaiting the Second Coming of Jesus Christ Gospel Church' don yarn say,if you like make you pray for pesin wey don die from now till tomorrow,e no make one single sense since di pesin no dey physical for dis world again.
He say instead,make we dey use our church mind dey PRAY for pipo wey still dey alive bicos na dem naim need di prayers.
Friday, 12 April 2019
RIVERS STATE GOVERNOR NYESOM WIKE DON DEY SING PEACE SONG GIVE 'AMEACHI' SAY MAKE DEM NO FIGHT AGAIN BUT JOIN HANDS TO MAKE RIVERS STATE GREAT AGAIN
If you dey follow naija politiks espeshali di River state wahala as e take concern Rivers state,you suppose know say,for over five years now di gofnor Nyesom Wike and him forma oga Rotimi Ameachi turn dem sef to cat and rat.
Di fight to boss ova Rivers politiks na real but afta Wike win di election for di state,him don come out dey beg Amesch say,make dem join hands to develop and make Rivers state a beta place for efribodi.
If you ask me,dis one na good move.
Thursday, 11 April 2019
TORi WEY DEY REACH US BE SAY,FOR GOTV TO STILL DEY NIGERIA, DEM MUST DO SOMETHING ABOUT DIA OPERATION LICENSE IF NOT,BYE BYE NA DIA NAME
One of di DSTV unit 'GOTV' wey many Nigerians dey use see front wen e come to cable television bizness,dey expiriens hard times right now as e take concern dia operation license for naija.
Dem get problem wit federal govment wey dem dey try to solve and if dem no solve am quick,you fit hear say dem no dey Nigeria again.
Saturday, 6 April 2019
SIMI DON YARN HER FANS SAY,SHE DON BAN YAHOO YAHOO BOYS FROM BUYING AND LISTENING TO HER MUSIC
Singa babe Simi don yarn say she don ban yahoo boys from buying and listening to her miuzik.
She yarn dis one during her joinbodi yarns wit her fans on top Instagram.
Dis table wey she dey shake so,hope say if e break she go get money to take call kapenta to repair ram?
Friday, 5 April 2019
'NA DIA PAPA GET STROKE' ---MR IBU DON REPLY PIPO WEY DEY CARRY RUMORS SAY SERIOUS STROKE DON PINAM DOWN
One ugly news bin come out yestaday say MR Ibu don get stroke sickness and e dey veri veri sirios.
Akordin to di tori,dem say dem carry Mr Ibu go native doctor ospita and he dey responde to tritment.
But e no reach one hour naim Mr Ibu say na stupid rumors wey him enimis dey spread.
On top di vidio wey him and him wife bring out,he say na di rumor pipo papa dem get stroke nor be him.
Watch di video for bottom hia...
Thursday, 4 April 2019
RAPPER 'ICE PRINCE ZAMANI' SAY,TO DEY PLAY GIRLS KONI KONI LOVE DON TIRE RAM SO DIAFOR,HIM DON READY TO MARRY AND SETTLE DOWN
Wednesday, 3 April 2019
DAVIDO UNCLE 'ADEMOLA ADELEKE' HOPE OF BECOMING OSUN STATE GOVERNOR DON HIT ROCK AS ABUJA HIGH COURT DON FIND FAULT FOR HIM WAEC RESULT
Davido uncle Ademola Adeleke of di PDP need sirios prayers if he won still bikom di Gofnor of Osun state afta Abuja high court don pass judgement say him no qualify to be PDP flag bearer for di Osun election wey dem do last year.
Although na APC pedin win di election but two weeks ago,di election tribunal declare Adeleke as di winner unto say magomago full di election.
Right now we dey wait Ademola Adeleke next action.
Monday, 1 April 2019
BLACKFACE DON TAKE HIM QUARREL WIT 2FACE TO ANODA LEVEL AS HE DON BLOCK 2FACE FROM HIM PAGE ON TOP INSTAGRAM
From friends to brodas,from brodas to enemies, na wa o dis Blackface and 2face fight na problem o.
If you dey follow up,you go don notice say dis two pipo no dey agree again afta Blackface accuse 2face of stealing him songs.
As we dey talk like dis,di mata sef dey court but bifor di next judgement, Blackface don vex block 2baba from seeing anything wey concern him Instagram as e don block am.
Who go settle dis pipo quarrel?
Di mata dey worse evriday by day.
Thursday, 28 March 2019
THE MAMA OF EGYPT SUPERSTAR FOOTBALLER 'MOHAMMED SALAH' DON DEY PARA SAY,SALAH FALL HER HAND AFTA PICTURE OF WIA SALAH HUG ONE FEMALE FAN SHOW FACE FOR INTANET
Mohammed Salah mama don dey para foram base on di picture wey come out online wia evribodi see wia Salah hug one female fan.
Salah mama say like say Salah papa eva do dis kain ting,not in for make her no comot for di marriage.
You know say moslems no dey like all dat kain ting espeshali wen di pesin no be ya wife.
Wednesday, 27 March 2019
HIGHLIFE SINGER FLAVOUR, DON BUILD SCHOOL FOR BLIND PEOPLE FOR LIBERIA TO TAKE CELEBRATE HIM BLIND FRIEND 'SEMAH'
Eva since Flavour Nabania turn friend wit dat Liberia small boy Semah G. Weifur,he neva look back to see how he go take add value to di boy life.
He dey go Liberia go visit di boy,sometimes he go carry di boy come Nigeria come stay witam.
But now,Flavour don close eye build school for blind pipo for Liberia.
Flavour post dis tori on top him Instagram page.
Why some don dey say,blind pipo no dey him kontri?some don dey praise am for di beta job.
Monday, 25 March 2019
NAIJA SINGA 'WAJE' DON CRY OUT SAY,MUSIC DON MAKE HER BROKE AND SHE NO GET MONEY TO PUT FOR HER MUSIC BIZNESS AGAIN
Waje, di auntie wey sing 'Do me,Do me' for Psquare song dat year,don cry out say,miuzik don finish all her money.
She say she don broke on top miuzik mata and she no get money to dey push her miuzik bizness again.
For inside the video wey dem don dey play for evriwia she say,her daughter school fees alone dey givam headache so diafor,make miuzik dey one corner.
Watch di video for bottom hia...
Sunday, 24 March 2019
PATIENCE OZOKWOR a.k.a 'MAMA G' DON YARN TORi PIPO SAY,E STILL DEY PAIN AM SAY HER FAMILY NO ALLOW HER MARRY Di MAN OF HER CHOICE WEN SHE YOUNG
If you dey follow up,you sopose know di no nonsense Mama G of nollywood base on di way she dey show pipo pepper for all her films.
Mama G wey her real name na Patience Ozokwor don yarn tori pipo say,she still dey bitter say dem no allow her marry di bobo wey she plan to marry wen she still dey young.
She say in those days na arranged marriage dey reign welwell as most times na ya famili dey choose who you go marry for you.
Friday, 22 March 2019
DAVIDO DON YARN SAY,ONE DAY HIM GO TRY HIM ACTING SKILLS FOR INSIDE NOLLYWOOD AND NA JAGUDA ROLE HIM GO LIKE TO DEY ACT
Supastar Davido don yarn tori pipo him dey nollywood wit corner eye.
He say him get mind to enta film acting one day but sha him no say na bigina for dat kind mata.
He say if he finally get di chance,him go like to dey act jaguda part.
Tuesday, 19 March 2019
MAKOSSA MUSICIAN 'KOFFI OLOMIDE' FROM CONGO DON RECEIVE 2 YEARS PRISON SENTENCE AFTA HE RAPE 15 YEARS OLD GIRL
One of di most popular voice for Makossa miuzik 'Kofi Olomide' don enta wahala afta court find am guilty onto say he rape 15 years old girl.
Dem givam two years suspended jail sentence for France and dis one mean say,dem no go waste time to arrestam if he enta any kind of wahala again.
Koffi Olomide wey be graduate of matimatics, get many of kerewa case wey dey hang for him head.
Even di girls wey dey dance and sing foram don bin confess say di man dey force dem sleep wit dem.
Monday, 18 March 2019
GOVMENT DON GIVE PROMOTION TO THE CUSTOM MAN WEY REJECT OVER N150 MILLION BRIBE FROM Di MAN WEY WAN SMUGGLE 41 CONTAINERS OF TRAMADOL ENTA NAIJA
As pipo wey bad plenti rish for naija,me and some few good ones still dey.
Di custom man from di Apapa area command Lagos,wey reject $420,000 bribe,don get promotion from gofment.
$420,000 for Nigeria naira na ova 150 millions.
Di bribe come from pipo wey bin won shift 41 containers of tramadol enta naija but dis man stand gidigba say no way! I can't allow una pass.
Many pipo don dey vex for di man say him for collect di money bicos di money too handsome.
Some say di money wey dem go add join him salary fit no pass 50k.
If na me be di man I for rejectam too.
I know say una no go won biliv.
Saturday, 16 March 2019
VICE PRESIDO AND PRESIDENT BUHARI SECOND IN COMMAND 'YEMI OSINBAJO' DON YARN TORi PIPO SAY,OGA BUHARI DON POOR PASS Di WAY WEY HE POOR BEFORE FOR 2015
Vice presido Yemi Osinbajo don yarn tori pipo say, President Buhari poorness level don pass church rat own.
He yarn dis one during di joinbodi groove wey him arrange wit pipo wey carry 'vote for APC campaign' for head during di elections wey just finish.
Akordin to Osinbajo he say,Buhari don poor pass di way wey him poor for 2015 wen he turn president.
Na wa for politishans sef!
Weda you dey support APC or PDP,all of us know how Oga Buhari look like di first time wen he enta Aso Rock.
Even I Go Dye neck dey learn for wia him neck dey.
Fast forward to today,di man don fresh like fresh bons wey dem just fry finish.
So Mr Osinbajo we nor undastand you at all,
Abi yarns don finish for ya mouth like comedian wey dey start work new?
Subscribe to:
Posts (Atom)














