MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 10 June 2014

MIKEL AND EMENIKE DEY QUAREL SIRIOSLY FOR SUPER EAGLES CAMP

Na smol ting remain Mikel Obi and Emmanuel Emenike for nearly throw blow for dia training camp for America wia dem dey prepare for di world cup wey go stat for Brazil on Torsday.
Dem say dis quarel don dey ground since last year and di tori bi say Mikel no get respet for di rest playas as dem say e too dey kari sholda go up.dis one kon dey vex some playas but na only Emenike kon gada heart telam say,"Mikel wetin u dey fil like? u bi God?
Di tin kon make Mikel para kon tell Emenike say,'Go to Hell!who u be?

And anoda tori wey wi hear bi say,during di frendly mash wey we play wit Greece and USA,dem say Mikel too dey guard ball and he no dey like pass ball wen dem expetam and dis one dey add join Emenike anoyance.
Supa Eagles coach Stephen Keshi naim kon act as dia papa and eldaly man to setle di mata for front of all di 23 playas wey im selet for di world cup.he tell dem say to dey fight is not gud at all.
As Keshi dey setle di mata,naim one of dem kon dey show imsef and e kon dey shout.
Dis one kon make Keshi  vex and telam say,'Sharaaaaaaaaaaaarap!! u no get respet for sinior man for una village?u know no say dis una quarel dey make us dey play robish for field?and Naija pipo don dey col us Supa Chickens again instead of Supa Eagles?erm!wot nonsense!
Keshi kon also warn dem say,if dem no stop dis dia quarel,he go giv dem red card and he go also put dem for bench.
Imidiately Mikel and Emenike hia dis one,naim dem setle quikquik,shake dia hands,hug demsef and kon even say,"DI DEVIL U ARE A LIAR! we are one family.
Shola Ameobi as di sinior playa for camp kon tell all di playas for di meeting say,make dem try copurate just like rice and pot and just like bread and butter so dat dem go make Naija proud for Brasil.
Di Supa Eagles go play dia fest match wit Iran on di 16 of dis month.

Saturday, 7 June 2014

DAVIDO,TIWA SAVAGE,FLAVOUR,CLARENCE PETERS DON MAKE NAIJA PROUD FOR MTV MAMA AWARDS,2014




DAVIDO
Like play like play all di award wey Davido don win since e stat to sing go soon full one drum as di bobo just win 2 award for di Mtv Mama Award wey shele for Kwazulu Natal,South Africa dis nite.di award dem na,di Miuzishan of di year for Africa and di Best miuzishan among all di bobos for Africa.
Dat tok wey oyibo pipo always dey tok say Naija pipo too get long throat kon show esef for di place as dat Sexy Mama,Tiwa Savage no allow eni geh use hand toch di award for di best miuzishan for di baby dem.Long throat!

TIWA SAVAGE

As Davido win di one for di bobos,Tiwa Savage kon grab di one for di baby dem.
Nor bi only two of dem put Naija name for map as Flavour Nabania,win di miuzishan wey sabi display pass for stage.
Di last Naija boi wey win award na Clarence Peters and na di Transform today by absolut award e win.

To know evribodi wey win award for di Mtv Mama Award,checkam for bottom hia:



 MIUZIK KATIGORI
Best Male:
Anselmo Ralph (Angola)
Davido (Nigeria) [Winner]
Diamond (Tanzania)
Donald (South Africa)
Wizkid (Nigeria)
Best Female:
Arielle T (Gabon)
Chidinma (Nigeria)
DJ C’ndo (South Africa)
Efya (Ghana)
Tiwa Savage (Nigeria) [Winner]
Best Group:
Big Nuz (South Africa)
Mafikizolo (South Africa) [Winner]
Mi Casa (South Africa)
P Square (Nigeria)
Sauti Sol (Kenya)
Best New Act:
Burna Boy (Nigeria)
Heavy K (South Africa)
Phyno (Nigeria)
Stanley Enow (Cameroon) [Winner]
Uhuru (South Africa)
Best Live Act:
2face (Nigeria)
Fally Ipupa (DRC)
Flavour (Nigeria) [Winner]
Dr Malinga (South Africa)
Zakes Bantwini (South Africa)
Best Collaboration:
Amani ft Radio and Weasel – ‘Kiboko Changu’ (Kenya/Uganda)
Diamond feat Davido – ‘Number One’ (Remix) (Tanzania/Nigeria)
Mafikizolo feat May D – ‘Happiness’ (South Africa/Nigeria)
R2bees feat Wizkid – ‘Slow Down’ (Ghana/Nigeria)
Uhuru feat DJ Buckz, Oskido, Professor, Yuri Da Cunha – ‘Y-tjukutja’ (South Africa/Angola) [Winner]
Artist of the Year:
Davido (Nigeria) [Winner]
Mafikizolo (South Africa)
Mi Casa (South Africa)
P Square (Nigeria)
Uhuru (South Africa)
Song of the Year:
Davido- ‘Skelewu’ (Nigeria)
DJ Clock feat Beatenberg – ‘Pluto’ (Remember Me) (South Africa)
DJ Ganyani feat FB – ‘Xigubu’ (South Africa)
DJ Kent feat The Arrows –‘Spin My World Around’ (South Africa)
Dr Sid feat Don Jazzy – ‘Surulere’ (Nigeria)
KCee – ‘Limpopo’ (Nigeria)
Mafikizolo feat Uhuru ‘Khona’ (South Africa) [Winner]
Mi Casa- ‘Jika’ (South Africa)
P Square – ‘Personally’ (Nigeria)
Yuri Da Cunha -‘Atchu Tchu Tcha’ (Angola)
Best Hip Hop:
AKA (South Africa)
Ice Prince (Nigeria)
Khuli Chana (South Africa)
Olamide (Nigeria)
Sarkodie (Ghana) [Winner]
Best Pop:
Danny K (South Africa)
Fuse ODG (Ghana)
Goldfish (South Africa)
LCNVL (South Africa)
Mathew Mole (South Africa)
Best Alternative:
Gangs of Ballet (South Africa) [Winner]
Michael Lowman (South Africa)
Nakhane Toure (South Africa)
Parlotones (South Africa)
Shortstraw (South Africa)
Best Francophone:
Arielle T (Gabon)
Espoir 2000 (Ivory Coast)
Ferre Gola (DRC)
Toofan (Togo)
Youssoupha (Congo)
Best Lusophone:
Anselmo Ralph (Angola) [Winner]
JD (Angola)
Lizha James (Mozambique)
Nelson Freitas (Cape Verde)
Yuri Da Cunha (Angola)

NON MIUZIK KATIGORI
Personality of the Year:
Chimamanda Adiche (Nigeria)
Omotola Jalade Ekeinde (Nigeria)
Trevor Noah (South Africa)
Lupita Nyong’o (Kenya) [Winner]
Yaya Toure (Cote d’Ivoire)
Transform Today by Absolut
Anisa Mpungwe (Tanzania)
Clarence Peters (Nigeria) [Winner]
Leti Arts (Ghana)
Rasty (South Africa)

Thursday, 5 June 2014

BABALAWO FOR GHANA SAY E GO USE WINCH AND JUJU TO STOP CRISTIANO RONALDO NOT TO GO WORLD CUP





One Babalowo for Ghana don say,forget mata!Ronaldo leg can neva smell di world cup wey go stat for Brazil nest wik.
He say im get di best Otumorkpor and naim bi di nomba one babalawo for di hole world.im dey fly korokoro for aftanun,im can fly for early momo and e fit also fly to America go folow Obama chop food for im dining table and Obama no go see am. inshot e can hold NEPA high tenshon wire for 5 hours and nortin go do am.
Dis babalawo wey e name na Nana Kwaku Bonsam,don tok dis tok b4 last Decemba say he go send one wicked injury to Ronaldo and e go shoot am itagba wey go make am miss d world cup or at list wey go make am no play against Ghana for di world cup.
Bonsam tok say,today na knee,2morow na leg,nest 2morow na big boil for him eye,even Ronaldo sef go fear fear for di kain problem wey e go get.
Nana Kwaku Bonsam,wey he name mean 'Devil of Wednesday' tok all dis one wen one radio stashon ,Angel Fm,intaviu am for Kumasi for inside Ghana.
He say im dey veriveri sirios for dis mata,even kpakpa sef,e enta town last wik go look for,4 bingos and na dis dog dem im take prepare di otumorkpor wey him call "Kahwiri Kapam" to take finish Ronaldo leg wit injuri. He say he don alreadi mix one spesha powda wit leaves plus konkonshun togeda,and e kon putam near Ronaldo image wey dem kav.
He say na dis one bi di final one wey e go take finish Ronaldo for ground.
He also tok say if Portuga like make dem kari Ronaldo go mit TB Joshua,or kariam to di best hospita for di world or if Ronaldo like make e use Odeshi,nobodi go fit cure dis injuri bicos e dey spirichua.
Ghana,Portuga,America and Germany naim dey d same group for di world cup wey go shele for Brazil.
Di World cup go stat nest wik and Ghana and Protuga go play each oda for June 26 .
So make we dey watch weda dis Nana Kwaku Bonsam juju go work.

BIAFRA OGA SAY MAKE EVRiBODi FOR NAIJA GO BUY COFFIN IF DIS KONTRI NO DIVIDE BY 2015.

ODUMEGWU OJUKWU


NNAMDI KANU
Di new oga of igbo pipo wey dey fight to get dia own kontri 'Republic. Of Biafra'for inside Naija,Mista Nnamdi Kanu,don tok say Naija go tie wrapper if we nor divide by decemba 2015.he say di kain bombs,guns,sword,bow and arrow,knife and cutlass wey dem go use,even America nor use am for iraq.he say,di mata go red!pure red.
Kanu tok say dem no go rest for dis mata until govament giv igbo pipo Biafra.he tok dis one for one join bodi wey e do wit dia membas and some ol' sojahs wey fight for di war wey dem take stat dis stroggle.
Na for Ngwo,Enugu naim dis meeting for apun and na to mark di fest edition of di rememberanse of Biafra day on May 30 and evritin wey shele for 1967 wen di Ogakpatakpata,Late Mista Chukwuemeka Ojukwu Odumegwu stat dis strogle for di Republic of Biafra.
Kanu wey bi di diretor of Radio Biafra,use di oportuniti comishon di statue to rememba di pipo wey die for di war.
He kon blast all di govament wey don rule naija afta di war stop for 1970 and also blast di present Jonathan govment say,all of dem dey mad bicos dem dey treat all igbo pipo like mumu and dem dey suffer and push dem go one kona.
He say e no know wetin dat oyibo man,Lord Lugard smoke wen im take go join north and south Nigeria togeda for 1914.
He say make all koret pipo of igboland for all ova di world join dem for dis fight to form dia own kontri.
He say no amount of join bodi meeting go fit solve Nigeria problems,so di best way na to divide Nigeria into pieces or into six.
Nnamdi Kanu say,if dem no divide Naija and giv dem Biafra by decemba 2015,dem go kill and turn evribodi to dead bodi and say e beta make evribodi go buy dia coffin for ground.
Akkordin to di tori wey our tori pipo gada,kanu also tank Ojukwu and evri oda pesin wey sakrifice dia lives for dis strogle. 












Tuesday, 3 June 2014

JAY Z AND BEYONCE WON BREAK UP BICOS OF CORNER CORNER AND KELEKELE LOVE



E be like say di rumors wey we dey hear no bi joke o!
Dem say Jay Z don dey para say,e bi like say,im wife, Beyonce don dey do konakona love,kelekele love and touching bodi wit her bodiguard,Julius de Boer.
Julius De Boer don dey work and guard Beyonce bodi for 5 years now.
Dis nor bi di fest time wey dis kain ''na u dey play me ojoro" rumors dey come out for dis 2 ogbonge miuzishans life.pipo dey tok say,Jay Z dey veri sure say,Julius de Boer dey play rich Beyonce website.
If u rememba,na dis same Julius naim stop Solange and Jay Z not to fight last month for inside lift for dat vidio wey lick come out. Solange,na Jay Z inlaw and Beyonce junior sista but dem get gbege for lift afta dem go groove for one parti for New York.
Di rumor stil dey go say,Jay Z dey fil say,di way wey Julius De Boer take dey cot eye for im wife anytime all of dem comot togeda enh,u go know say,sometin,dey pipeline.
Di two of dem don born one pikin wey her name na Carter Ivy.
Papa ivy,even want make dem sack di bodiguard last February,but Beyonce say she go kill hersef if Jay Z sack Julius.
Well,nor be only Beyonce di olofofo and aproko pipo dey blame o,in short dem say Jay Z sef dey BULALA oda malawis apart from Beyonce.
So,dem say wetin Beyonce dey try do,na...,do me,i do you,God no go vex.
Anyway we go just siddon dey look weda dis kelekele love rumor go scata dia marrage or dem go settle di mata once and for all.

STEPHEN KESHI DON DROP NATIONS CUP ORIGINAL BOMBOY,SUNDAY MBA AND SIX OTHERS FOR WORLD CUP.


Di bobo wey score di only goal wey Naija take win di nations cup last year,Sunday Mba,nor go get di chance to show im skills for World Cup wey go stat for Brazil in 10 days time.
He dey among di 7 playas wey keshi drop dis morning.although sha di bobo enta camp late bicos say im paypers and passport get smol problem.weda naim make Keshi dropam nobodi kon know or na bicos im liv Warri Wolves wey he dey play gud futbol for jejeje,kon go sign for divishon 3 club for France or even kpakpa sef,weda na maybe he don loose form,nobodi still know.na only Keshi naim know y he dropam.
Oda playas wey dem drop na Daniel Akpeyi,Nnamdi Oduamadi,Joel Obi,Obinna Nsofor,Ejike Ozoenyi and Nosa Igiebor.
I ask some pipo for some strit dis morning say,how dem see di list?and many of dem tok say,dem no supose karry Chigozie Agbim bicos di bobo no sabi keep at all.one guy kon even tok say Agbim worse pass Agbonibasket.
Among all di 23 playas wey Keshi chuz,na only Joseph Yobo,Osaze Odemwingie,Vincent Enyeama and Elderson Echiejile,don go world cup b4.

To see di list of all di playas wey Keshi selet,checkam for bottom hia:

GOALKEEPAS:
Vincent Enyeama
Austin Ejide
Chigozie Agbim

DEFENDAS:
Joseph Yobo
Elderson Echiejile
Juwon Oshaniwa
Godfrey Oboabona
Azubuike Egwuekwe
Kenneth Omeruo
Efe Ambrose
Kunle Odunlami

MIDFIELDAS:
John Mikel Obi
Ogenyi Onazi
Ramon Azeez
Michael Uchebo
Reuben Gabriel

STRIKAS:
Osaze Odemwingie
Ahmed Musa
Shola Ameobi
Emmanuel Emenike
Babatunde Michael
Victor Moses
Uche Nwofor.

Monday, 2 June 2014

TUFIAKWA!!! MY PIKIN, DAVIDO,NO SUPPOSE BE MIUZISHAN.

Omobabolowo,Davido dat young but mighty miuzishan wey bi 21 years old,don tok say Mr Adeleke,di man wey be im papa,bin no want make im do miuzik bicos he fil say miuzik na for pipo wey nor sirios and many pipo wey don chuz to dey sing no achiv anytin for inside.
But sake of say he no giv up for wetin Baba God don sign for im life,now,im papa sef naim bi him nomba fan.
E get one stage wey di mata kon rich,im papa just want make he hamma for anytin wey Davido chuz to do.weda na to dey swim he chuz o,or to dey run 100 metre and play table tenis or even kpakpa sef,to dey do bricklayer work,e papa just want make e suceed.
Wen tori pipo kon askam say,among all im miuzik,wich one im like pass?di bobo kon tok say ha!e no easy to chuz o!
Even tho say pipo like all im gbedu like Dami duro,Skelewu,Aye,All of you,e get di way wey Skelewu dey totori am for bodi anytime wey im hearam.
Davido don win plenti award.even as we dey tok so,dem don chuzam for pipo wey fit win Mama award dis wikend,B.E.T award for America for June 29 and N.E.A for August.




LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...