MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 9 July 2014

ETIM ESIN SAY MAKE MIKEL GO WATCH ORIGINAL NUMBER 10 "JAY JAY OKOCHA" VIDIOS TO LEARN FOOTBALL

MIKEL OBI
Forma Nigeria intanationa futballer Etim Esin don yab crase comot for Mikel head bicos of di pregnant woman futbol wey di bobo play for dis year world cup for Brazil.
He say for dis Brazil world cup,Mikel na big disgrace to imsef and di numba 10 jesee bicos he dey run like confuse man for fid and he wonda why dem dey allow ram wear nomba 10.Weda na Akara Mikel go fry for Brazil or na ground nut he go select we nor kon know.
Nowadays goalkeepers dey close dia eyes if Mikel hold ball bicos dem know say he canot skor.
Etim Esin say yor name must be Mikel if as a nomba 10 u no fit try goalkeeper wit shot sometimes or even kpakpa sef skor goal.
Etim say check out No 10s from oda kontris like Messi,Sneider from Holland,Neymar and even sef dat smol rat from Colombia James Rodriguez wey skor 6goals for dis world cup and Mikel no even try any keeper oddnary one shot.even kpakpa sef Abedi Pele pikin,Andre Ayew skor 2goals out of 3 match wey Ghana play but Mikel own tire ram.
ETIM ESIN




Etim Esin say Mikel try for South Africa 2013 nations cup but he fool imsef welwel for Brazil.
He say im no get anytin against Mikel o bicos im dey among di fest pipo wey praise Mikel wen he stat to play for Nigeria say,he go bicom a veri wondaful player but rite now he sorprice say Mikel just dey play robish.
He also tok say wen Osaze and Musa dey busy dey take freekicks and kona kicks,Mikel own na to dey trek for field.
Etim Esin kon give Mikel one advice say make e try go watch di vidio kaset of Jay Jay Okocha and Henry Nwosu and even im sef to learn how numba 10 dey play ball.

Tuesday, 8 July 2014

ARM ROBBERS DON ROB 5.8 BILLION NAIRA FROM SAMSUNG FACTORY FOR BRAZIL

Apart from futbol skill,Brazil pipo don show say dem get arm robbery skills full bodi and dem don show say dem dey multi talented for plenti tins.
Just yestaday for Brazil,20 arm robbers break enta Samsung phone factory, tiff ova 40,000 fones,laptops and oda eletronics.
All di tins wey dem tiff full seven trailers.
Dem say if u dey dia,u go fil say na action film dem dey shoot but film trik no dey dis one.
Na 12 midnite naim di Jankolikos take brake enta di factori wey dey sampinas near Sao Paolo and tiff propatis of ova Five point eight billion naira(5.8billion naira).
Akkordin to di police for di area,wen di arm robbers enta di place,di fest tin dem do na to use dia Ak 47 guns bail up and soranda all di gate men and ova 200 workas and take dem sleep for ground say, "if dem try any robish or move,dem go kill all of dem like fowl".
Di robbers dress like di workas and kon even put  di Samsung company id badge for dia shirt take do cova up enta di factory.
Di operashon last for ova 3 hours and di way wey di jankolikos take know wia dem kip all di phones and laptops make pipo dey suspect say somebodi wey dey work for dia,na informa to dem and he know about dis operashon.
Samsung tok say nobodi die for di operashon sha and nobodi injor and di company dey corprate wit police for di investigashon.
Brazil na one place wey poverty take hand toch ground welwel and majoriti of di pipo gada togeda and protest against di big moni wey govt spend for dis year FIFA world cup wey dey shele for dia kontri rite now and go soon end.
Brazil go play Germany and Argentina go play Holland for di Semi Finals to know who go play for di final for july 13,2014.

DI GIRL WEY DEM CLAIM SAY DIE FOR EJIGBO PEPPER TORTURE MATA,NEVER DIE

EJIGBO TERRORISTS













Dat geh Juliana Agoma wey di hole world report her stori of how dem take pour grinded pepe for her website for Ejigbo,Lagos,no die aftarol.
If u rememba,di vidio of how market agbero take torture Juliana and her sista and her mama,come out for intanet and plenti pipo watcham.
Dis vidio wey nor swit for eye at all at all,hapun for Oba Morufu Market for Iyana Ejigbo,Lagos last year Febuary but na dis year January naim evritin wey hapun,come out.
Di lida of one assosiashun wey stand on dia own witout govament soport,Joe Okei-Odumakin,wey di name of her assosiashun na ''Women Arise For Change Initiative'' naim carry di mata for head say govment must arrest di pipo wey giv di gehs dem and dia mama beta beating and also put plenti pepe for dia website.
Many tins don hapun since di day wey dis mata hapun til today as police don arrest 8 pipo including one woman di Iyaloja of Iyana Ejigbo Market and di mata don dey court alreadi.tho sha dem stil dey find four pipo wey get hand for di mata.
But di new tori now be say,di geh wey dem put almost 200 naira pepe for her website no die even tho na wetin tori pipo report bicos na wetin dem hear be dat.
Akkordin to one family memba,he say dem force dem make dem tok say,dia sista don die from di injuris wey she get from di beating.
Di pesin wey dey represent police for tori mata,Frank Mba,tell tori pipo say,govment send policemen from the Federal Special Anti Robbery Squad go her town for Tchaada community for Ifaguin area of Benin Republic but dem no see wia dem tritam wit native merisin bifor dem claim say she die and even her grave sef dem no see.dem also visit di police stashon for Tchaada but her dead bodi file and statement no dey dia.
No be onli dia dem waka go as dem also carry waka go meet di tradishona rula,di Baale of Juliana town and di Baale kon confirm say Juliana stil dey alive.
Di Baale kon even invite Juliana twin broda kon palace for intaviu and di broda kon confirm say truetrue say her sista dey alive and she dey stay anoda nearby village.
Mr Mba say dem go dey disiv demsef,disiv di pipo and di law if dem charge di 8 pipo go court for killing and meanwhy no evidence of dead bodi.
Now sha ,Mba say dem go take dem go court for "trying to kill pesin'' and dat one sef na heavi offense.

Saturday, 5 July 2014

GOTV DON SIGN JOHN OKAFOR AKA "MR IBU" AS FACE OF GOTV


MR IBU
Big name for home vidio mata,Mr ibu John Okafor don hama anoda one again as GOTV di ogbonge cable tv pipo don make am dia korect bobo nomba one.
JOHN OKAFOR
Mr ibu di Nollywood mumu,don use im mumu take dey put plenti korect food for im table and put plenti moni for im bank account why many guy men wey dey form fine boi no pimples,dey drink garri sleep witout shuga and milk.
So if na shit u dey pack make u packam well,if na gutta u dey dig make u digam well.if na kponkpo u dey carry make u carryam well bicos anytin can hapun.
Akkordin to di kontrat wey Mr Ibu sign with GOTV,he go dey appia for dia adverts,dia party and any impotant join bodi wey dem won do.
Di rison why GOTV appointam akkordin to di  General Manager of GOtv Nigeria, Elizabeth Amkpa, bi say di bobo sabi make pipo laff welwel and he fans plenti welwel bicos dem bilivam finish for di wok wey im dey do.
GOTV also biliv say dem go gada plenti costomas wit im face and dia bizness go dey grow.
No be only GOTV don sign dis kain kontract wit Mr Ibu as GLO signam too for june to be dia persona pesin.
Naija,una no biliv say Ibu need manager wey go hepam dey manage dis moni?



BRAZIL WONDA BOY,NEYMAR,NO GO PLAY FOR DI WORLD CUP AGAIN.

INJURED NEYMAR
Di golden boy of Brazil footbol,Neymar no go play at all again for di remaining match wey Brazil go play b4 di world cup go end on di 13 of july,2014.
Colombia playa,Juan Zuniga,naim brake Neymar back bone wit im kung fu fotbol durin di quata final match bitwin Brazil and Colombia for dis year FIFA world cup wey dey shele for Brazil gon gon gon.
Neymar don alreadi skor 4 goals for dis tonament as im skill don let dem quolify for di semi final but dem get to beat Germany to fit enta di final.
NEYMAR
Among di kontris wey remain for di world cup,na onli Holland and Costa Rica naim neva win di world cup b4.Brazil don winam 5 times,Italy don winam 4 times and Germany don winam 3 times.

Friday, 4 July 2014

PHYNO SAY MUSIC LANGUAGE NA "GET UP AND DANCE"

PHYNO
Di King of ibo rapping,Phyno,don yarn say miuzik no dey hear italo,e no dey hear urhobo,e no dey hear ibibio,e no dey hear portuguese.e say di onli language wey miuzik dey hear na 'get up and dance' espeshiali if e sweet welwel.
For all ova di world plenti pipo fit die for makossa miuzik mata even tho dem no dey hear wetin dem dey tok but dem dey enjoy di melody.
Phyno tok say di South Africa jam, 'Khona' wey Mafikizolo sing,na one of di most popula jam since last year enta dis year and Naija pipo no dey hear dia language and dem no dey hear wetin dem dey sing about but we like di miuzik die.he say na di way u dropam naim mata.
Phyno don sing many beta jamming jamming wey make plenti pipo like am for Naija.many aboki like am,pipo for Benue like im miuzik,for Jos nko?dem like im miuzik,for minna dem like am.
Most of dis pipo no dey hear ibo but dem dey enjoy di way wey di bobo take dey rap fire.
Phyno say,make e no lie sha,im fear di fest fest time wen he stat to rap for ibo language,but now God don ansa im prayer.evrytin don sengemenge.
Di bobo don sing plenti beta miuzik like Parcel,Alobam, street miuzik,Obago, Man of the Year,Ghostmode wey im join bodi do wit Olamide and di one wey illbliss putam 'AmachiKwanu'
Rite now,Phyno and Olamide dey collabo to do one album togeda and dem go soon finish di wok.
Shay u trust dis bobos say dem go diliver?

Wednesday, 2 July 2014

MARADONA SAY ONAZI ENEMY,MATUIDI, WORSE PASS SUAREZ THE BITER.

STUPID TACKLE
Maradona don blast FIFA,Pele and Beckenbauer  say,as Matuidi don injor Ogenyi Onazi for ground,shay dem don quiet dia mouth like say dem use evostic gum dia mouth.he say dis dis two old papa and FIFA get big mouth to tok robish evritime but wen dem sopose yarn dem no go hear dem yarn.
Maradona say di kick wey di bobo wey dey man France midfield,Blaise Matuidi troway give Onazi worse pass di bite wey Luiz Suarez bite Giorgio Chielini during di world cup match wey Italy and Uruguay play for Brazil.
Many pipo curse Suarez welwel bicos dis nor bi di fest time wey Suarez dey bite since e stat to play profeshona futbol.dem even say e be like say na di same skul im and Clifford Orji attend.
MARADONA

Now Maradona don say make pipo forget Suarez bite,even tho FIFA ban am for 4 months,na Matuidi kick naim bi di real crimina offense and dem soppose to givam beta ban.
He say Matuidi nor go for di ball at all.di way wey im take go for Onazi leg just be like say na grasscutter naim e won kill.robish futbol!
Upon di wicked kick on Onazi,na ordinary yellow card naim di Ogogoro referee from Amerika giv Matuidi and dis one vex Maradona welwel.
Matuidi don alreadi apologise to Onazi say make e no vex say na di handwork of di devil.
France go play Germany for quatafinal as dem later beat Nigeria for di match 2 kondo afta Onazi injor.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...