Dem realy talk am say if yeye won smell e dey smell finish.
America singa,Toni Braxton attend UNCF evening groove wey dem organise for stars wit her two bois shidren,Denim and Diezel on sunday April 12 for inside Atlanta,Georgia.
Di kain see tru dress witout bra wey she wear naim kon tire pipo as dem dey wonda say as mama weda she supose dress like dat.
Make i no yarn too much.
Check out di pichors for yorsef.
You go happy if yor mama dress like dis?
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Tuesday, 14 April 2015
DAVID TAM WEST SAY BUHARI GO REDUCE FUEL PRICE TO 40 PER LITRE
Forma minista for Petro mata,Tam David West,don tell Naija pipo say, dem fit sleep wit dia two eyes close and expect jolliment bicos him biliv say new presido,Buhari go reduce price of fuel from 87Naira to N40 wen he start work from May 29.
He yarn dis one wen vanguard call am for telefone to talk for some kain mata wey concern us.
He say forget mata for mathias,no shakement bicos hin no wetin Buhari go fit do.
Tam West wey be petro minista unda Buhari khaki regime for 1984 yarn say, di new presido go bring fresh confidens to di oil industri and he also yarn say baba na strait forward pesin bicos im know am like di back of im leg.
Di forma Oga for petro mata say Muhamedu Buhari go build new refanaries make fuel and kerosine for dey yanfuyanfu for poor pipo to use bicos no beta govment go like to dey see di pipo dey suffa.
David Tam West say no need to look far bicos naija get all wetin dem need to make life beta.
Anoda tin wey im yarn be say e don tey wey Buhari dey tell evribodi say hin nor won hear subsidy mata for him ears.
Thursday, 9 April 2015
CRISTIANO RONALDO DON SCORE 300 GOALS FOR REAL MADRID IN 7 YEARS
If player skor 20 goals for one season for him club bifor,na big achivment but di level wey Ronaldo and Messi don take di skorin of goals mata reach,don pass be careful.
Dis two football wizard dem dey skor over 50 goals evri season for di past five years.
Just last night for di match wey Rayo Vallecano and Real Madrid play,Ronaldo skor im 300 goal for Madrid out of 288 match wey he don play for di club since he join dem for 2009 from Manchester United.
Di club of forma Super Eagles goalkeeper,Wilfred Agbonivbare wey die of cancer for january,Rayo Vallecano,no get answer to Ronaldo goal for di 68minute as he nod Dani Carvajal cross enta net.
Just on Sunday here,Ronaldo skor five goals for one match as Real Madrid beat Granada 9-1.
Di TING WEY TINUBU TALK ABOUT OBA OF LAGOS AFTER HE YARN SAY IBOS GO PERISH FOR LAGOON
Naija new President,Muhammedu Buhari,don beg Igbo pipo make dem forgive Oba of Lagos,Oba Akiolu Rilwan,afta im misyarn say any Ibo Pesin(Omoibo) wey no vote for APC and Ambode as Govnor for Lagos,go perish for Lagoon.
Buhari yarn dis one on tuesday wen he visit Lagos for APC rally.
He say make dem forgive di Oba make peace for reign.
Anoda pesin wey yarn for di rally na former Lagos State Govnor and APC national leader,Bola Tinubu.
Tinubu say make pipo forget wetin dem write for motor bodi enta motor, bicos di Oba yarnings nor represent dem bicos him no be APC memba.
Tinubu also yarn say naim be di fest yoruba govnor wey apoint Ibo man as comishona for Lagos.
He say since PDP loose di president election to APC,dem don dey yarn dust just to drag APC name enta wetin di Oba talk so dat e go affect Ambode make he for loose di election.
He say Ifeanyi Ubah and anoda big name for PDP Bode George,no know wetin dem dey talk.
Jagaban,di nickname of Bola Tinubu also talk say,wetin Ifeanyi Ubah go do for Oba Akiolu palace in di fest place?
He say weda di Oba na politician?He say di Oba role na to unite all di parties weda na PDP,APC or even sef SDP.
He also ask Igbo pipo one question say,"Govment no dey pay dia shidren school fees join for di free education"?
Di forma govnor say one spelling competition wey dem do one time na Ibo boy,Ebuka from Anambra state naim win and dem sendam go Switzerland computer shool and also Obafemi Awolowo Univasiti.
No be only dat one Oo, as Ebuka also rule Lagos for one day as Govnor.
He also talk say dis Ebuka kon later bicom executive for Oando and he dey Canada now.
He say even sef,na Ibos naim win di spelling competition three straight times.
He say anoda boy,Felix also go Switzerland and OAU and dem no deny am him scholarship bicos say him na Ibo boy.
Thursday, 2 April 2015
DAVIDO AND WIZKID REALLY DON SETTLE DIA QUARREL AS TWO OF DEM WEAR Di SAME CLOTHES
Wen Bob Marley sing say your worst enemy can be yor best friend, and yor best friend fit be yor worst enemy,pipo feel say na Kwale Igbo(marijuana) he smoke dat year.
But today now, Naija Supastar miuzishans, Davido and Wizkid don show say di King of reggae no sing dat song troway as Davido don post pishor wey im and Wizkid for wear di same clothes.
Two of dem kwanta bin pass cat and rat own bifor but last year naim dem finally decide to turn friends again.
See di pishor for bottom hia:

Saturday, 28 March 2015
LIST OF NIGERIA CELEBRITIES WEY GO VOTE FOR JONATHAN OR BUHARI
For all ova di world,pipo wey dey contest for election always dey want make superstars and celebrities support dem bicos of di kain respect and mouth wey dis stars get for dia area and di world and di mata no differen for naija as many of dem don declare dia support for eida APC or PDP.
Some of dis celebrity fit just on dia own start to support dis candidates bicos dem feel say di pesin go deliver if dem vote foram or sometimes most of dem fit don collect heavy raba and wen dia pocket don swell,dem go begin sing di praise of di pesin and if posibo sef dem go even dey yarn dust join.
Some of dis Celebrities go turn Yeyebrities if di candidate of dia choice no win.
Anyway sha dat one na tori for anoda day.
For naija,make I give una di list of superstars wey go vote for eida Goodluck Jonathan and PDP or General Muhammadu Buhari and APC today for who go bicom Naija Presido for di next four years as all dis celebrity don earlier declare for public rallies and ameboristic site like facebook,twitter,instagram and oda gbogbonye site who dem want.
#CelebritiesForGoodluckEbeleJonathan
Rita dominic,Sammy Okposo,Omawunmi,Oc Ukeje ,Mike Ozuronye,Oritsefemi,Afrocandy,
Ramsey Noah,Patience ozokwor,Gordons,Ini edo,Daddy Showkey,Mercy Johnson,Bovi,Toyin Aimakhu,Mochedda,Ibinabo Fiberesima, Onyeka Onwenu, Kate Henshaw,Monalisa Chinda, Joseph Benjamin, Femi Ogedemgbe, Joseph Yobo
Onyeka Onwenu, Fred Amata, Daddy Showkey, Ben Murray Bruce, Funke Adesiyan, Ruggedman, Essence, Segun Arinze, Joseph Benjamin, Fidelis Duker, Omoni Oboli, Femi Ogedengbe, KCEE, Monalisa Chinda, Eedris Abdulkareem, Zaaki Adzee, Harrysong, Majek Fashek, Omo Baba, Patience Ozokwor, Zeb Ejiro, Charles Novia, Naeto C, Omawumi, Ini Edo, Toyin Aimakhu, Emem Isong,Obesere,Saheed Osupa.

#CelebritiesForGeneralMuhammaduBuhari
Desmond Elliot,Tony One Week,Dayo 'D1'Adeneye,Olamide,Kenny St Brown,Don jazzy,9ice,Funke Akindele,Ice prince,M.I,Uti Nwachukwu,Banky W,Yemi Alade,Tiwa Savage,M.I,Ice Prince,Fathia Balogun, Muyiwa Ademola,Sanyeri,Adebayo Tijani, Wasiu Ayinde KWAM1,Femi Adebayo,Weird MC, Banky W, Funke Akindele, Yemi Alade, Muyiwa Ademola,Yomi Fash Lanso, Dammy Krane, DJ Jimmy Jatt, Flavour, Saidi Balogun, Ronke Oshodi Oke, Femi Adebayo, Lola Idije, Dayo Amusa, Sola Kosoko, MC Kirikiri, Shola Shobowale, Muyiwa Ademola,General Pype, Femi Adebayo, top celebrity stylist Swanky Jerry, Sanyeri Afonja, Kamilu Kampo, Odunlade Adekola, Adebayo Salami, Lagbaja, Mercy Aigbe, Yinka Quadri, Fathia Balogun, Foluke Daramola.

WHO YOU WANT AS NAIJA FIRST LADY?
Di office of di first lady na one office wey di Nigeria constitution and law no recognise at all and even tho say the late Maryam Babangida di wife of di forma Khaki Presido,General Ibrahim Badamasi Babangida add style and efizzi to di First Lady life style,dis one neva still make di law recognise di office.
Nigeria First Ladies mouth nowadays sharp pass parrot mouth.
If u nor know di role of di President u go tink say na dia wives be President bicos of di way wey dem don use dia hand arrange dia office to get beta respect.
Anybodi wey win today election to bicom Naija Presido,automaticalli him wife go bicom di First Lady of The Federa Republic of Naija.
So area!
As dia husband don enta battle field today to know who go win di gbege wey dey ground,who you want to bicom your First Lady for naija?
Shey na di defending champion,Patience Jonathan or Aisha Buhari?
Shey na Mrs Chekwas Okorie or Mrs Onovo or Mrs Kelani or Mrs Sam Eke?
Or even kpakpa sef,Abi na di only woman wey dey contest with di men dem today to bicom Presido,Mrs Comfort Sonaiya husband, naim u won see as Naija First Man?
Oya make u yarn yor own...

![]() |
| PATIENCE JONATHAN |
![]() |
| AISHA BUHARI |
| PATIENCE JONATHAN |
Subscribe to:
Posts (Atom)