MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Wednesday, 3 June 2015

USAIN BOLT NA BAD NEIGHBOUR FROM HELL FIRE- SEAN PAUL WIFE

BOLT AND JODI JINX
U fit dey your own,u no go know say some kain of yor doings wey u take as normal,dey abnormal to oda pipu.
Dis na exactly wetin dey appun bitwin di fastest man,di man wey sabi tia race pass for di world,Usain Bolt and grammy award winning reggae miuzishan,Sean Paul wife,wey her name na Jodi Jinx.
Jodi Jinx don accuse Usain Bolt of noise polution for dia area.
She also yarn for facebook say Usain Bolt na neighbor from hellfire bicos he dey disturb di area wit too much noise.
She say,di loud noise  from cars,motorcycles and di loud miuzik from Usain Bolt house fit make pesin run mad.
She also yarn say apart from di bike noise,na so so party and so so shout Usain Bolt sabi and she no fit wait to park comot for di area.
She say she no get one singo respect for Bolt again bicos na evriwia he dey carry him bad karata go.
She even yarn say, although pipo love di bobo welwell sha,but na bad example to di world.
Jodi Jinx say two times now for dia area,Usain Bolt don shoot gun gbosa! gbosa! and di gunshot sef fit deaf pesin ears.
Some pipo nor go too blame di 100 and 200 mita record holder, Usain Bolt for di loud miuzik bicos, apart from di race,di oda work wey dem know am for,na DJ work.
DJ BOLT
Usain Bolt and Jodi Jinx husband,Sean Paul neva yarn anytin for di mata but plenti of Bolt fans won kill her wit curse for twita and facebook including reggae,dancehall miuzishan,Popcaan.

Tuesday, 2 June 2015

THE JUMIA MOBILE WEEK MEGATHON DON COME TOWN


My pipo My pipo,i hail una.
If you be pesin wey know wetin dey for Naija and u dey follow Jumia di numba one,ogbonge online shop, wia u fit buy koret goods,you go know say,anytime dem say big ting won appun,dem no dey joke,e must appun.
I bin plan to kip dis sikrit but how i won take kip sikrit wey no lemme kip?
My pipo,i no fit kip dis one,i must yarn una.
Oya read my sikrit for bottom hia:

Dis time ehn,dem call am di biggest buybuy ever,'The JUMIA Mobile Week Megathon'.
Dis deal na about plenti betabeta phone wey dem go sell and e go take place from di 1st of june to 7th of June.
Guy,make i yarn you beta.
You go fear fear bicos na di biggest phone-selling groove wey u go eva hear of be dis.
So if yor phone don lost bifor or you won change am bicos e get fault,or your plan na to get di latest phone, or even kpakpa sef if yor plan na to add anoda phone join di ones wey u get bifor,naim be say you sabi someting.
If u get all dis plans for yor head and you kon dey look for crazy price wey go make u bow, make you sharpaly carry waka go, (www.jumia.com.ng/megathon) and join other pipo for di Jumia Mobile Week Megathon and get other informate bicos di counting of di days wey remain for dis joliment to start, don bigin.
Jumia go run dis show wit ogbonge phone compinis for Di Jumia Phone Week Megathon.

Dis deal nor be wetin pesin supose miss for him life and e go involve beta and koret phone wey di biggest compinis go push enta market.
Now wey di mata stil fresh,to be part of dis beta jolliment,make u quikquik download the Jumia App.
For dis June enh,u must get new phone,i must get new phone,my grandmama must get new phone,evribodi must get new phone.
Di Jumia Phone Week Megathon,go appun from june 1st to june 7.
Make u no say i no yarn you o?
U beta ready,
U beta do kiakia.
Una weldone.

Wednesday, 27 May 2015

WIZKID POSE WITH HIN N8 MILLION POWER BIKE

Money good o
See Wizkid dey flenjor wit hin pawa bike wey dem say na 8 milion naira dem dey selam!
Starboy tins.
Expensive abi?
Dis him expensive pawa bike showface some few days afta Wizkid release him new miuzik,'Expensive Shiit'.
But wait o!
Dis pawa bike no too big for dis bobo so?
We no won hia tori afta about dis ovaload  bicos na so my broda dey complain plenti years ago say hin pawa bike dey fall press am evritime.
Nobodi tell my broda say 'okokobioko' na noun bifor he rush selam troway.
I go siddon dey look.
I wish him and he new dog luck.

.

Thursday, 21 May 2015

CHINEKE!!! SEE AS OBAMA TAP HIM WIFE YANSH!

Di most pawafu man for di world,America presido,Barrack Obama no send anybodi message o!
Check out dis pishor below as he tap him wife,Michelle yansh for public.
No be say e concern me sha o but i just say make i let my pipo know wetin dey pipeline.
But come o,
Wetin Obama bin dey tink?
He feel say he wife yansh na drum wey dem dey beat?
Obama you be drummer boy or drama boy?



Wednesday, 20 May 2015

MY WIFE NA VIRGIN BIFOR I MARRY AM - OSHIOMOLE


Govnor Oshiomole of Edo State wey just marry one new sugar peperenpe,don kontiniu to tell di world some secret wey nobody askam.
Di forma NLC presido yarn say,him new wife, Lara Fortes, na virgin and nobodi don visit her website bifor he meet di shenkez.
He yarn all dis one for di wedding thanksgiving service wen he dey teach and talk sense enta di head of di youth membas of di church make dem no dey use dia John Thomas and tomato do bad tin bifor dem marry.
He also teach dem make dem run far from anytin corruption.
During dis yarnings,Oshobaba boast say,naim be di fest pesin wey torchlight hin new wife website and he want make di youth dem learn how to keep dem sef holy until di time don reach instead make dem enta town dey sleep around.
Make i tell una sometin.
Na rumors Ooo!
Rumors wey dey reach our tori room be say,dem say Oshiomole buy di girl Palleh and Malleh private jet make dem take jolly sake of say,dem train dia pikin veri well and dem no allow anyboy dance awilo near her website.

Tuesday, 19 May 2015

DAVIDO DON GET HIM FIRST PIKIN


Naija star,Davido,don welcome im first pikin and di pikin na baby girl.
Alltho, as at wen dis tori enta our news room, Davido neva talk anytin concerning dis baby or di babe,Sophie Momodu wey born di pikin.
Di pesin wey first talk and congratulate Davido,na Dele Momodu di owner of Ovation magazine.
Dele Momodu and Sophie Momodu na cousins and Dele kon send congratubia message to him cousin and Davido for dia new born pikin for inside instagram thru enjoygram.
Di question wey pipo dey ask now be say,so, Dele Momodu dey happy now say small boy Davido,give him cousin,Sophie belle witout bride price and marriage? 
Davido na 22 years and Sophie na 28.
For naija nowadays,our miuzishans no send marriage again even wit dia plenti moni as na baby mama dem dey get now.
Wizkid get baby mama,Ice prince get mama,Flavour Nabania get babay mama and rumors wey we dey hear now be say anoda girl,forma miss Nigeria,19 year old Anna Banner, don carry belle for Flavour too.
Chai!
Badoo,Olamide,get baby mama,May d get baby mama,2face nko?
He get plenti baba mama bifor he kon finally marry one of dem,Annie Macaulay.
And now Davido don join di baby mama owners club of Nigeria.
I go siddon dey wait to hear wetin Davido  go talk.
Weda he go deny di pikin and di mama or him go gree say dem be him propati.
Sidon look na dog name.

Tuesday, 12 May 2015

CHAi !!! NIGERIA DEBT DON HIT N12 TRiLLiON NAIRA


Di money wey Nigeria dey owe thru borrow borrow,even kakulator no fit kakulate am again.
Di kakulator wey my oga try to use for office to konvat di N12.062 trillion to dollar,explode for hin hand and katch fire!
If u be pesin wey dey follow Naija mata welwell,u go know say for di 1990s,our debt no plenti at all.
Wich way democracy?
Dis 12 trillion naira,na money wey Naija dey owe as at march 31,2015 and i know say e go don rise welwell by now.
We stil dey wait for di latest data from the Debt Management Office (DMO) for di month of April and dis month to know how much he don enta.
My queshon now be say,
Wetin dem borrow all dis money take dey do?
Our refineries no dey work.
even student no dey gree carry excursion go our refineries again bicos notin dey appun for dia.
No good roads,potholes,potholes full evriwia, school fees dey inkriz evriday, our doctors dey strike anyhow,Agege bread sef don cost.
Kpomo wey plenti pipo take dey see front even tho say e no dey give anytin for bodi,don cost die.
Na yahoo-yahoo most of our graduates dey do afta school bicos no work.
Di ones wey gofment manage give job,dia salaries dey smell bicos e no reach pinch.
NEPA dey one side dey crase dia own.
No need to talk about fuel skasiti bicos,to look for needle wey fall for inside river, dey easy to see, dan to see fuel buy for filling station nowadays.
Na wa o govment.
Wich way Naija?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...