MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 11 June 2015

NICKI MINAJ OLD AND NEW BOYFRIEND;WHO GET SWAG PASS?

Rapper Nicki Minaj,di ikebe queen and her boyfriend of twef years Safaree Samuels,no dey again and dis one no be news.
Di news be say she don get new boyfriend, Meek Mills and di bobo sef na rapper.
Nicki Minaj fans across di world don dey even begam make she try settle wit di Jamaica born Safaree bicos di guy swagga no be here.

Make i sampo una some picchors as pipo don dey argue about who get swag pass among dis two bobos.
Bitwin Meek Mills and Safaree,who get swagga pass?

Na di  di old bobo,Safaree?
Or di new bobo,Meek Mills?

Check out dia photo for bottom hia:


SAFAREE AND NICKI MINAJ
NICKI MINAJ AND MEEK MILLS


Wednesday, 10 June 2015

BUHARI NO SABI DRESS AT ALL - GHANA TV PRESENTER


Ghana tv presenter,Gabriel Enoch don blast naija presido,Muhammadu Buhari dressing to di 2015 G7 meeting for Germany.
He yarn for twita say, wen Africa leaders and dia yeye dressing go improve sef?.
Di G7 kontris take photo togeda plus Buhari and na only Buhari no deck suit and dis one kon give Enoch mind to dey yarn opata.
Di truth be say no be by force to chop okro if u dey forbid am.
If Gabriel Enoch wey be Africa pikin from Ghana no biliv in Africa culture naim be say him head don knock.
America,UK, Japan, France, Canada and Italy and Germany naim make up di G7 kontris and dem invite Buhari come dia meeting as one of di guest.
Di other guest wey dem invite come to di G7 meeting na,Ethipia Prime Minister,Hailemariam Desalegn
Iraq Prime Minister,
Haider al-Abadi,Liberia President,Ellen Johnson Sirleaf,
Senegal President, Macky Sall,
Tunisia President,Beji Caid Essebsi and Ban Ki-moon di United Nations Secretary-General.



Tuesday, 9 June 2015

SEE AS DOG DEY RIDE BICYCLE

Wondas shall neva end.
Check out as dis dog dey ride keke like human being.
Di dog wey di owners nickname Barry di Bedlington,turn star afta he learn how to ride dia pikin tricycle for England.
Di dog learn fast pass dia pikin sef.
U get dog or any pet?
Wetin dem don do wey surprise you?



OGOGORO DRINKING GO LAND YOU FOR PROBLEM IF WE CATCH YOU - FG

Ogogoro na acid for bodi from today akordin to govment.
Federa govment don ban ogogoro alias 
kai-kai for naija.
Di director general of National Agency for Food and Drugs Administration and Control, NAFDAC, Dr. Paul Orhii naim yarn dis one on monday.
He say na 38 pipo don die for Rivers state sake of say dem shack ogogoro and wack dog meat recently and dem no go fit fold hands dey look until e kill evribodi.
Rivers state don alreadi banam since last week for di state.

Apart from Rivers,pipo don die for Ondo state too and dem stil put all di blame for Ogogoro head.
Dis ban go affect many Ijaw,Urhobo,Itsekiri and many oda malleh dem from other area wey be say na dis bizness dem take dey take care of dia family.
I rememba ebola wen dem say na bush meat dey cause am.
Bush meat sellers carry protest enta town say make govment find anoda excuse say bush meat na koret meat.
I go siddon dey watch how di mata go end weda dem go protest or dem go change enta anoda bizness.

Thursday, 4 June 2015

CISSE DON MARRY ANODA BABE FOR HIM GIRLFRIEND BACK


Senegal footballer,Papiss Cisse don brake di heart of him girlfriend into smalsmall pieces.
Graham Rachelle forma Miss Newcastle beauty queen and model still dey struggle to gada di pieces togeda.
Cisse wey dey tap leather for Newcastle United for England,no tell him white girlfriend,Rachelle anything bifor he fly go marry volleyball star, Awa Diallo for Paris.
Rachelle and Cisse don dey do dis kelekele love for over two years now but dis oyibo pepper get di shock of her life wen she see di wedding picchor of Cisse and Awa for facebook and instagram.
She say wetin pain am pass be say, Cisse no letam know about him plans as dem spend beta qualiti time togeda recently.
CISSE AND AWA DIALLO + RACHELLE



Cisse marry Awa for one swish yatch club on May 30, three days afta Rachelle hep di bobo pack him bag and escortam go enta aeroplane for airport and she kon even sama Cisse goodbye kiss bifor he enta di plane.
One Rachelle friend later yarn pipo say,di rizin why Cisse no date her friend wit all him heart na bicos, di footballer family expectam to marry Africa muslim woman.
Papiss Cisse na strong muslim wey no dey drink and na five times a day he dey pray.
Sorry Rachelle, it is well.

Wednesday, 3 June 2015

USAIN BOLT NA BAD NEIGHBOUR FROM HELL FIRE- SEAN PAUL WIFE

BOLT AND JODI JINX
U fit dey your own,u no go know say some kain of yor doings wey u take as normal,dey abnormal to oda pipu.
Dis na exactly wetin dey appun bitwin di fastest man,di man wey sabi tia race pass for di world,Usain Bolt and grammy award winning reggae miuzishan,Sean Paul wife,wey her name na Jodi Jinx.
Jodi Jinx don accuse Usain Bolt of noise polution for dia area.
She also yarn for facebook say Usain Bolt na neighbor from hellfire bicos he dey disturb di area wit too much noise.
She say,di loud noise  from cars,motorcycles and di loud miuzik from Usain Bolt house fit make pesin run mad.
She also yarn say apart from di bike noise,na so so party and so so shout Usain Bolt sabi and she no fit wait to park comot for di area.
She say she no get one singo respect for Bolt again bicos na evriwia he dey carry him bad karata go.
She even yarn say, although pipo love di bobo welwell sha,but na bad example to di world.
Jodi Jinx say two times now for dia area,Usain Bolt don shoot gun gbosa! gbosa! and di gunshot sef fit deaf pesin ears.
Some pipo nor go too blame di 100 and 200 mita record holder, Usain Bolt for di loud miuzik bicos, apart from di race,di oda work wey dem know am for,na DJ work.
DJ BOLT
Usain Bolt and Jodi Jinx husband,Sean Paul neva yarn anytin for di mata but plenti of Bolt fans won kill her wit curse for twita and facebook including reggae,dancehall miuzishan,Popcaan.

Tuesday, 2 June 2015

THE JUMIA MOBILE WEEK MEGATHON DON COME TOWN


My pipo My pipo,i hail una.
If you be pesin wey know wetin dey for Naija and u dey follow Jumia di numba one,ogbonge online shop, wia u fit buy koret goods,you go know say,anytime dem say big ting won appun,dem no dey joke,e must appun.
I bin plan to kip dis sikrit but how i won take kip sikrit wey no lemme kip?
My pipo,i no fit kip dis one,i must yarn una.
Oya read my sikrit for bottom hia:

Dis time ehn,dem call am di biggest buybuy ever,'The JUMIA Mobile Week Megathon'.
Dis deal na about plenti betabeta phone wey dem go sell and e go take place from di 1st of june to 7th of June.
Guy,make i yarn you beta.
You go fear fear bicos na di biggest phone-selling groove wey u go eva hear of be dis.
So if yor phone don lost bifor or you won change am bicos e get fault,or your plan na to get di latest phone, or even kpakpa sef if yor plan na to add anoda phone join di ones wey u get bifor,naim be say you sabi someting.
If u get all dis plans for yor head and you kon dey look for crazy price wey go make u bow, make you sharpaly carry waka go, (www.jumia.com.ng/megathon) and join other pipo for di Jumia Mobile Week Megathon and get other informate bicos di counting of di days wey remain for dis joliment to start, don bigin.
Jumia go run dis show wit ogbonge phone compinis for Di Jumia Phone Week Megathon.

Dis deal nor be wetin pesin supose miss for him life and e go involve beta and koret phone wey di biggest compinis go push enta market.
Now wey di mata stil fresh,to be part of dis beta jolliment,make u quikquik download the Jumia App.
For dis June enh,u must get new phone,i must get new phone,my grandmama must get new phone,evribodi must get new phone.
Di Jumia Phone Week Megathon,go appun from june 1st to june 7.
Make u no say i no yarn you o?
U beta ready,
U beta do kiakia.
Una weldone.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...