If you dey look for book wey get plenti inspiration to read, make u no
look far again as di life of di Nigerian Idol season 5 winna,K-Peace, na
beta book to read.
Watch out for yor area as very soon, di bookshops and cd shops wey dey near you, go soon stat to dey sellam.
From
ordinari pure water,gala and chin-chin hawker, K-Peace don hama as he
win N7.5 million,one Hyundai Sports Utiliti motor,record deal with
Univasal Miuzik for South Africa, and he go also carry joliment waka go
sleep for five star hotel and chop high grade chin-chin,drink korect
wine for Dubai and all di bill na from di pocket of di organizas of
Nigeria Idol.
Olakunle Ogunrombi A.K.A K-Peace, enta street go hussle afta him papa wey be di bread winna of di family die of heart attack.
Di bobo say im come from a family of five and to chop 3 times a day no be problem for dem.
Infact,wen dem dey grow up,him papa dey always buy dem chocolate,donkwa,kulikuli,
goody goody,biskit, anytime he dey come back from work.
Bifor K-Peace papa die,he work for Leventis Motors as engineer.
Afta dat work finish,he enta motor parts bizness and naim he take dey take care of di family.
But as di old boi kpai,naim yawa gas.
Di mama no fit carry di load alone as tins kon konk and kon dey veri hard.
Dis one kon make K-Peace vex enta street.
He hawk chin-chin,gala,pure water sotey, he turn hawking king for traffic just to sorvive afta him papa die.
But bifor he enta hawking,di bobo say him do factory work for Maza-Maza from 7am to 5pm and na one N120 dem dey pay am and anytime wey he do ovatime join,dem go add N30 join di money.
K-Peace
stop di work afta one year and kon enta hawking bicos di KevinLittle
wey di company dey pay am,no dey reach am do anytin.
But now,Baba God don shook hand for di guy mata as levels don change.
K-Peace
don finally find peace wit him singing talent as he don win di Nigeria
Idol season 5 and di rest as dem talk am, na history.
Area!
I hail una.