MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Tuesday, 21 July 2015

'MONKEY' FALL FROM PALM TREE,BREAK SPINAL CORD BICOS OF N300

For Mkpuma Agbaja in Izzi local government of Ebonyi State last weekend, one bobo, Mr Egede Nwofe, wey he nickname na 'monkey' fall from palm tree and break him spinal cord.
Akordin to Mr Nwamimi Okwuta, di man wey get di palm trees, he say for di past five years naim he don dey hire Nwofe to helpam harvest palm fruit and dat kain tin neva appun bifor.
Wen tori pipo carry waka enta dia village go hear from dem,Mr Nwofe yarn say, di money wey him dey make from di palm tree climbing,naim he take dey feed im family.

He say na N500 him dey collect for tall palm tree and N300 for short one.
For dat day, Mr Nwofe don alreadi climb three trees.
He say as he dey climb di numba 4 tree,naim him bodi start to dey shake like shakespeare, Cold kon enta him.
Bifor he say Jesus! him don reach ground break him spinal cord.
Spinal cord wahala no be small pikin problem.
We wisham goodluck as he dey recover.

Monday, 20 July 2015

KWEKE!!!! BUS DRIVER VEX NAKED HIMSELF TO PREVENT LASTMA TO ARREST HIM BUS

Wen some pipo don make up dia mind say dem go die for some kain mata,nobodi fit change am.
Dis na exactly wetin one bus driver do dis afernoon for Allen Avenue for Ikeja as LastMa seize him bus sake of say he break traffic law.
Bifor u say siddon look is a noun,di driver don naked imsef one time and tanda gidigba for front of him bus dey shout say, make Lastma kukuma jamam die instead of dem to arrest him bus wey dey give am im daily bread go dia office.
Leave mata for mathias.
To carry last nowadays no dey anybodi dictionary.

SHUOoooo!!!! OBASANJO ABEG LEAVE JONATHAN ALONE - AYO FAYOSE

Some days ago if u dey follow up,u go don hear wen Obasanjo yarn say, pipo from Niger Delta go suffer tey bicos of di way wey Jonathan take rule.
Akordin to OBJ,he say Uncle Jona no use di oportuniti wey him get to rule dis kontri well at all.
Him say so diafor,to pick anoda pesin from dat area go hard.
Bifor di presido elections for April wey Buhari win,Obasanjo withdraw all im suport for Jona.
Earlia today, di Govnor of Ekiti state,Ayo Fayose don release statement say make di grand Palle of Naija politiks Olusegun Obasanjo, stop to attack forma presido,Dr Goodluck Ebele Jonathan from left,right and centre bicos no be di man be president again.
Ayo Fayose di one man mopol of PDP,say make he try leave Jona make he leave him private life jejely since he don give Aso Rock chance.

Thursday, 16 July 2015

MAJEK FASHEK: I GO CURE MY CRAZE AFTER I RELEASE MY NEXT ALBUM


Reggae miuzishan,Majek Fashek, don yarn afta he carry waka go one church say make dem no force am go place like Uselu, wia dem for dey cure pipo craze or pipo wey small nut don loose for dia head.
He say him spirit go dey low if dem force am.
If you rememba three weeks ago,di whole intanet scata wey dem say Majek dey beg ogogoro waka nowadays and dis one kon make Area Fada,Charly Boy beg naija pipo make dem join am to hep di reggae star.
Pipo also dey yarn say,di ting wey putam for dis problem na bicos, di ganja farmers product wey him dey smoke no good for him bodi.
Majek say him know how he take dey escape dis tritment bicos God don givam differen differen knowledge like orisha and babalawo knowledge.
He say naim ancestors knowledge he dey use right now and him dey drink akpeteshie (ogogoro) wit di orisha idea wey him get.
Di Rain maker wey him jam,"Send Down The Rain" reign scata dat year say, him go take di tritment afta he release him next album.
HIS ROYAL FRESHNESS,MAJEK
His Royal Freshness,one of Majek Fashek guy name some years ago bicos him skin fresh finish like fresh vegetable in dose days yarn say, he no want make him spirit dey low bicos na Jesus be him hero,Lord and Saviour and naim don carry am reach dis level.
Majek say make pipo calm down afta di album bicos he no won enta hospital now bifor somebodi go givam bad injection.


GHANA MUSICIAN,STONEBWOY DON REJECT GLO N18 MILLION

STONEBWOY
Ghana miuzishan of di moment,Stonebwoy and him team don tell GLO make dem kip dia N18 million naira wey dem won take make am ambassador for dia network.
Di bobo say di raba too small foram and di conditions for di contract no favor ram.
For example,he no go fit play for any shows wey oda network like Mtn and Etisalat organize.
Di BET Awards winna wey also win Ghana artiste of di year,don study di kontrat and conclude say,him level don big pass dat money wey GLO dey offaram.
We hope say he no go regret dis action sha bicos dem talk am say,a bird in di hand even tho e fit shit for yor hand, beta pass 20 birds for inside bush.

Wednesday, 15 July 2015

EEDRIS TO DAVIDO: WHY YOU GO DO VIDEO ABOUT COCAINE


Pipo don dey shook mouth put for di kwanta wey buss out bitwin NDLEA and Davido as
Naija supastar,Eedris Abdulkareem don blast Davido for di cocaine part for him latest video.
For some days now,di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, don dey investigate why Davido go use him korokoro eyes dey do sabisabi about cocaine mata for di video of "Fans Mi".
Akordin to NDLEA,dem say na veri bad example from Davido as he nor teach pipo any beta ting apart from say he dey advatise cocaine.
Dem say if to say na arrest dem arrest pipo wey dey do cocaine bizness for di vidio,dem for even congratulate am for a good job and even enta partnaship and do bizness witam.
For di same mata, Eedris don blast Davido say why he go use cocaine for him vidio?
He yarn dis one for inside HipTv news.
He say America rappas fit dey do drugs vidio for dia side but we no supose dey copy dem.
Di Nigeria jagajaga singa say,make pipo use dia office take do beta tin.
He also yarn say miuzik nor be only about to dey show naked gehs wey dey shake yansh but also to pass beta message to educate and inspire shidren.

Wednesday, 8 July 2015

SEE AS TEACHER BULALA Di YANSH OF STUDENT WITH 100 STROKES (WARNING; Di PHOTO NO GOOD FOR EYE)

One tisha for one of the most popular school for Delta State,Government College,Ughelli,don fall him hand as he scata di yansh of him student with cane.
He flog di poor boy 100 strokes sake of say di boy follow him fellow student fight bicos of him own spoon.
If u see di yansh of Ebikabowei Daniel,di boy wey di tisha flog,you go feel say dem forget di yansh for fire.
Why wicked pipo plenti pass good pipo for dis world?
If na yor pikin or broda dem bulala im yansh like dis,wetin u go do to di tisha?

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...