America rappa,Snoop Dogg,don tell all him Sweden fans say make dem blame dia police pipo for di swear wey him swear say,him no go eva visit dia biutifu kontri again.
Snoop yarn dis wan on top twitta on sunday afta Sweden police stopam for road,arrestam go station and force am to piss for cup sake of say dem won do test wit di piss to know weda igbo(marijuana) dey him system.
Snoop bin go do show for di university town of Uppsala Stockholm,Sweden.
Snoop later yarn say na bicos him na black man naim make dem tritam like dat but di police pipo say na lie bicos na dia work dem just dey do.
If u check and balance am,u go blame Snoop?
For police to arrest am go station from him car and force am to piss for cup and no be say dem catcham wit igbo,naim be say dat wan pass opression.
Di PiDGiN English BLOG Wey Dey Sama u FreshFresh Gist and Any Tear Rubber TORi For Di World. AS E DEY HOT....RECEiVE Di TORi KiAKiA.
MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER
Monday, 27 July 2015
UNA MUST PAY ME ONE BILLION NAIRA - KESHI DON TELL NFF
Super Eagles forma coach,Stephen Keshi wey Naija Futbol Assosiation sack sake of say him no value him job,don write dem leta to tell dem say na N1billion naira dem go arrange am as dem sackam.
He say dem do wrong to sackam as dem don robish him pesin base on di contract wey him sign as Eagles coach.
Akordin to one tori pesin wey know about di mata,he say NFF receive Keshi leta on friday from one Kaduna base lawyer compini.
Four months afta dem givam di job,NFF sack Keshi July 5 afta dem conclude say di coach no value him job as he apply to coach Ivory Coast di sametime wen he still dey unda kontrat wit NFF.
Thursday, 23 July 2015
MAJEK FASHEK DON DEY WORK ON HIS TEETH SERIOUSLY
Naija answa to Bob Marley, Majek Fashek don see chomchin and he dey pass tru some deep issue.
Some even they say na spiritual problem why some say na drugs turn him life upside down.
Dis past few years no easy for Majek Fashek as many tins don go wrong for him life style.
One of dis problem na di color and di setings of he teeth wey don nearly scata finish.
If u know Majek Fashek bifor all dis plenti wahala start for him life, u go know say him teeth dem no be as dem be bifor.
Now,if Majek smile,you go shock if u see him teeth.
I no undastand weda na tabacco naim do am like dat but as somebodi wey don watch am live dey play him kpangolo style of miuzik. bifor, i no say dis man get koret teeth dat year.
Di good news be say Majek don start di re-arrangement of him life,starting from his teeth as he don carry waka go meet dentist(doctor for teeth mata).
Him friend Black Rice post for facebook di pictures of wen di teeth doctor dey work on Majek teeth.
Black Rice also write for facebook say "dem dey tank evribodi wey donate and kontriboot to see Majek stand gidigba again.
He say naija pipo kindness dey show wella and e dey work for Majek bodi.
NO BE ONLY BUHARI DEY DO MISTAKE AS VAN GAAL,CALL PLAYER 'MIKE', INSTEAD OF ''CHRIS''
During one join bodi siddon talk wit tori pipo,
Manchester united coachee,Louis Van Gaal,forget di name of him player and call am "Mike Smalling" instead of "Chris Smalling".
Pipo bin laff President Buhari welwell anytime wey he no call di name of any animal,place or ting corectli.
For example,Buhari won say Germany,he kon say West Germany.
He say ANPC instead of APC.
He supose say Chancellor Merkel but he kon say President Merkel of Germany.
Even our vice president name,Buhari call am Osunbade instead of Osinbajo during campaign but now we don know say it can appun to anybodi.
On tuesday for America wia Man U for dey train dey prepia for di new season,dia Coach Van Gaal follow tori pipo dey yarn about who him three captain dem be.
He kon misyarn say na 'Mike' instead of 'Chris' naim be di numba three captain.
Wayne Rooney naim be Manchester United captain.
Michael Carrick na numba two why Chris Smalling na di numba three captain akordin to Loius Van Gaal.

Wednesday, 22 July 2015
TUFIAKWA!!!! BUHARI DON REJECT AMERICA GAY MARRIAGE OFFER
President Muhammedu Buhari don show say no be evritin Nigeria dey copy from obodo oyibo as he don reject gay marriage offer from America as he say na madness and he dey against our culture.
Di pesin wey dey represent di president for tori mata,Mr Femi Adesina talk say na true say di waka wey Buhari carry go America,dem sell di idea of make Naija agree make man dey marry man and make woman dey marry dem sef too.
But Buhari say tufiakwa! we no mumu reach like dat and dat kain tin no fit appun for hia.

TIWA DON BORN BOUNCING BABY BOY
Di first lady of mavin records,Tiwa Savage along her husband,Tee Billz,don welcome dia first pikin togeda.
Ogakpatakpata for Mavin records imsef Don Jazzy naim break di good news for twitter and Tee Billz imsef don confam di tori as he post photo of wen he hold di pikin hand.
Congratulabia!
Ogakpatakpata for Mavin records imsef Don Jazzy naim break di good news for twitter and Tee Billz imsef don confam di tori as he post photo of wen he hold di pikin hand.
Congratulabia!
Tuesday, 21 July 2015
GABON PRESIDENT TURN TO MESSI DRIVER
Lionel Messi spend last saturday for Gabon wen he go hep lay foundation of one new stadium wen dem won build.
Di stadium go contain 20,000 pipo wen dem build am finish and na di president of Gabon Ali Bongo Ondimba naim hostam.
Akordin to di president,wen he visit Barcelona some years ago,Lionel Messi promise to visitam for Libreville,Gabon one day.
He say Messi na man of him words as he honor di waka.
Tori wey dey reach our table be say na N1.6 billion naim Ali Bongo pay Messi bifor he agree to carry waka come Gabon.
So wich one be dis one wey dis president dey yarn say Messi promise to visitam?
Ova to una pipo of Gabon.
Messi don dey eat from una national cake.

Subscribe to:
Posts (Atom)