MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Monday, 2 May 2016

GOVNOR OSHIOMOLE DON INKRIZ WORKERS SALARY FROM N18,000 FOR EDO STATE


Dis na gud news for Edo state gofment workas as di gofnor,Adams Oshiomole,don close eye inkriz dia salary to take selibrate workas day from 18k to 25k.
Nor be to inkrizam be di koko,na to fit dey pay dem bicos many states nor dey fit pay di 18k wey dem fix.
Like di gofnor of Osun state for exampo,nor fit pay workas salary for almost a year.
Even now wey Federa gofment don even hep solv di ploblem,na half salary naim dem dey pay workas from level 8 and above since July,2015.
Oshiomole! Oshiomole! Oshiomole!
How many times I call you?
Nor let Edo workas use swear kill u o!
Kip yor part of di promise o bicos na you use your mouth promise dem.

NO SHERE KANBIA FOR ZAMBIA: SEE WIA WIZKID CLIMB TO PAFORM FOR ZAMBIA


Wizkid di Starboy,dey waka round di world rite now dey entatain hin fans.
Some weeks ago,he go show dem di Fire Congo.
Just last week,na Sierra Leone president naim welkomam as he go plasta dat area wit hin star pafomans during dia indipendense selibration.
On Saturday,na Zambia pipo katch di Wizkid Fever as he fil up dia ears wit hin koret sound.
He even climb pole to sing for dem.
Tank God say him nor fall brake teeth,na hin village inosent winch dem for blame.
How e dey be again if u nor call dis one grace.
#LokeLoke.


YOU DON SEE V-BOOT YANSH BIFOR? CHECK OUT DIS PEUGEOT YANSH


Wetin pesin nor go see for dis world?
Akordin to sombodi dem say na Cotonou dem snap dis pishor.
Dem sow trauza and put Peugeot light take disignam.
Na diferen types of dis trauza naim dey availabo.
Benz,v-boot,Audi,Cherokee,all of dem get dia own.
Babe talk true u fit wear dis kain trauza?

Sunday, 1 May 2016

CHAi! EDUCATION DON DIE FOR NAIJA! NATIONAL ANTHEM DON SUFFER FOR DIS SHIDREN MOUTH(video)


Wetin dey appun for our nation?
Wetin make naija shidren dey fear to know book nawadays?
Di time wen i small like dis shidren,na so so first I dey carry wit beta result,sotay I kon popular for school.
Imagine dis shidren dey sing national anthem like fowl wey dem swear for.
Wetin dey behind dis kokonut water brain wey dis shidren dey get now?

Watch di robish naija nationa anthem wey dis shidren dey sing make u undastand wetin I dey yarn.


Watch anoda one hia....

And anoda one hia....

NO MORE KISS: SEE WETIN BAD LIPSTICK DO ONE BABE


Shakara don end for dis woman til forda notice.
Odnari lipstick naim do person dis like dis so.
God forbid!
Na wetin we wake up jam be dis as one woman Lily Cleopatra Maurice from her hospita bed,post on top Facebook wetin Queen kolekshon lipstick do am.
Lily from Orlando,Florida for America say,na small tin dey kill pesin.
Na inside sleep for nite naim she bigin choke as dem rush her go hospita.
Wen I first see her lips,I bin tink say na dragon kissam as her lips swellop like bread wey dem soak for water for 19days.
Di kompini wey get dis Queen kolekshon product,go hiaram as dia market go fall press dem yakata.
Dia bizness go drop,I trust pipo.




DiARIS GOD O! PATIENCE JONATHAN DON DROP POLITICS AND TURN TO EVANGELIST AS HER FACE APPEAR FOR CRUSADE POSTER


If u tink say God nor fit call u one day to do Him work,na lie you lie.
If u like hide unda rock,if u like hide on top tree,if u like hide for inside pot or cupboard,wen di Holy Spirit briz blow rich yor kona,you must come out from yor hiding.
You kanot kontiniu to dey drink ogogoro all yor life.
You kanot kontiniu to do ashawo all yor life.
If forma First Lady and Uncle Jona wife,Patience Jonathan fit turn evangelist and dey prich di word of God,who say u kanot get yor own church?

Payshi name,appia for inside one big bana as one of di pipo wey go minista for one prayer crusade for Port Harcourt and dis crusade go appun next tomorow.
Shine yor eye welwell,u go see Patience Jonathan face for di pishor wey u dey see so.
Diaris God true true.
Praise da Lord!!!!

NA MAN DEY GRAB WOMAN YANSH OR NA WOMAN DEY GRAB MAN YANSH? (Fotos)


Hmm,tins don dey turn upsaddan for dis word o.
Na man dey like to always dey grab babe yansh wen dem dey waka bifor but nawadays,e be like say tables don turn.
See dis malawi as she grab her bobos yansh for dia bifor-wedding pishor.
You blame am?
Babe grabam as u like,na yor propati.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...