MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 7 July 2016

65 YEAR OLD WOMAN DON SET INTANET ON FIRE WIT HER SEXY BODi (pictures)


For a 65 year old woman to stil sexy like dis,abeg fear God.
Plenti exercise na one of di tins wey fit make old mama yongi get dis kain killa shape.
Di only ploblem wey I get wit dis mama be say,she nor sopose open bodi like dis bicos she sopose be ezampo to di world.
But...di mama set sha.
I know say many gehs go jealous dis wicked shape wey dis mama carry.
See more of her foto for hia.
Mama di mama.

Wednesday, 6 July 2016

DEM DON SENTENCE MESSI AND HIM PAPA TO 21 MONTHS FOR JAIL


Futbol baddest playa Lionel Messi of Barcelona and hin popsi don get 21 months for jail bicos of ojoro wey dem play tax ofishas.
For obodo oyibo dem nor dey use tax play and if u nor pay your tax na big kasala for your head be dat.
But di gud tin about Messi own be say dem go allowram dey play hin ball but dem go dey watcham for dis 21 months weda he go fall dia hand so dat dem go root am put for jail.

Tuesday, 5 July 2016

OGA DON SHOOT HOUSE GIRL FOR KADUNA JUST BICOS HE OWN PIKIN WAKE AM UP FROM SLEEP WIT CRY


Sometimes I go dey vex say why God even krate dis world wen I see extra wickedness for dis world.
Owna of haus and oga,Jamilu,shoot hin haus geh just bicos he pikin wake am up wit cry one aftanun for Kaduna.
Akordin to di tori,wen di pikin dey cry,as dem telam say hin wife nor dey,naim he carry di blame for di haus geh head.
Jamilu nor fit bear di vex naim he bring out gun shoot di nanny.
As he see di nanny fall for ground,he call di area chairman,yarnam wetin dey appun.
Di area chairman quik quik call di comishona of police and di mata dey police station now.
Di geh dey hospita dey resiv tritment but di tori don dey wan get k-leg as we hia say Jamilu dey lie say na wen he dey klin hin gun naim he shoot di geh by mistake.
We even hia say he don try bribe di haus geh make she lie say di gun wound na mistake.
Also he don try to bribe di kominiti lida too make dem for troway di case but God nor go letam eskape  from dis wickedness.



Monday, 4 July 2016

KISS DANIEL DON YARN US WHY HE NOR DEY DO KOLABO WIT PIPO


Kiss Daniel,one of di miuzishan wey dey serve us beta jam rite now,don clear di air on why he nor dey do kolabo wit hin felow miuzishans.
Akordin to di Woju singa,he say di record konpini wey signam get law wey him dey folow.
Di law be say na only pipo wey dey di label naim he go fit work wit for now.
G-world entatayment naim Kiss Daniel rite now and oda pipo wey dey di label too na Sugarboy and Dj Shabsy.
Kiss Daniel say for now di tin nor go work but maybe later he can do kolabo.
If u rememba earli last year,Daniel do kolabo wit Tiwa Savage and Davido on top di baddest jam 'Woju',di same jam wey clear road for di bobo.
Abeg who undastand wetin Kiss Daniel dey yarn?
Abi di Woju remix nor be kolabo?

COACH SAMSON SIASIA,DON CHOOSE COMEDIAN GANDOKI AS PESIN WEY GO DEY KRAK JOKES FOR OUR UNDA-23 TEAM FOR DIS YEAR OLYMPICS


Dis year Olympic game go appun later dis month for Rio de Janeiro,Brazil.
To avoid storis dat touch,di coach of our unda-23 team,Samson Siasia,don pick warri boy Gandoki as di komedian wey go dey crack jokes for di team so dat dia mind go dey swit enta field.
Dis kain tin go hep free di playas mind and in case anytin block dia brain to take tap koret leda,Gandoki jokes sopose hep free di brain but my only konsign na,wot if dem loose match like 5 kondo to dia oponent?
Shey dem go get mind to listin and laff to di bobo jokes?
Gandoki dis work nor easy as u dey tink o.
I trust u sha.
U get use all di expirience wey u don gada all dis years take see front in case e red.
Watch di vidio of Gandoki choosement for bottom hia...



Sunday, 3 July 2016

I GET Di INVOiCE OF Di MONEY WEY I PAY MAJEK FASHEK MANAGER BIFOR I REMIX 'SEND DOWN Di RAiN' - TIMI DAKOLO


Timi Dakolo don ansa Majek Fashek wey akiuz am of tiffing hin song witout say dem nor telam.
Timi remix 'send down di rain',di song wey put Majek name for map.
Now di rain maker don blast Timi Dakolo say Timi take advantage of hin sickness go reliz hin spiritual song.
Majek say hin fast for seven days bifor God givam di song but Timi nor pass thru dat kain wahala.
He say di bobo nor dey origina naim make am do wetin he do.
He also yarn say na only pipo like 2face,Wizkid and Olamide dey origina.
Timi Dakolo don come out yarn say,
Shuo!Him pay Majek manager and hin stil get di resipt to show di bizness.
Timi say him nor be dat kain pesin wey nor undastand say u can't just carry remix somebody song witout he nor know.
He say Majek na one of di best miuzishan wey him know bicos di man dey put life into miuzik.
Timi Dakolo nor waste one singo time as he rosh enta intanet to tell pipo say make dem nor biliv all dis tori.

CHECK OUT DiS BUHARI HOTELS FOR INDIA


Di sharp eyes of tori pipo camera,don kapchor 'Buhari Hotels and restorant' for India.
Di only tin now be say,weda na una President Buhari getam or na someone else wey dey bear di name getam,we neva know.
Di hotel full India and na since 1951 e don dey exist.
Nor be only one pesin dey bia Buhari but trust me,we must find out wich of di Buhari getam.
If na una president get dis hotels,naim be say he get queshons to ansa.
Make una dey pray make e be say naim getam.
He don tey wen he ansa queshons last.
Di kweshons fit fayvoram but we nid to hia fromam.


LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...