MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Sunday, 17 July 2016

WICH KAIN CALL UGANDA PRESIDENT SIDDON DEY MAKE FOR EXPRESS ROAD?


Yoweri Museveni,di Uganda long throat president wey don dey rule for ova 29 years,stop for express road kon dey make 30 minutes call akordin to him press seketri for Facebook.
Di president escort,block di road and dem even carry chair givam make he sidon dey make call.
Nor be say na cripple.
He dey carry chair folow bodi?
I nor know why Africa lidas dey like to show dem sef.
How dis one wey he dey do for road take join for good life wey di Uganda pipo say make he giv dem?
Small time now,na kpomo he go dey go cut for market like Fayose.
E be like say Fayose don sell efizzi give dis president wey won rule Uganda for 100 years.
Now diferen pipo don dey mockam wit dia own pishors.
Yeye dey smell.
See some of di pishors wey pipo fotoshop for botom Hia...







OSHIOMOLE DAUGHTA DON BEG PIPO MAKE DEM LIVE HER PAPA ALONE MAKE HE ENJOY Di MARRAGE TO HIM NEW 25 YEARS OLD WIFE


Since Edo state gofnor,Adams Oshiomole marry dat yellow 25 years old sisi from Eritrea,Lara Forte,many pipo don blastam and many stil soportam.
Now Oshiomole dota,Winifred Isimakhome Oshiomole,don beg naija pipo make dem allow her papa enjoy di marage.
She say many pipo just dey yarn opata about her papa afta di marage.
Winifred say she nor blame dem sha bicos dem nor know half of di stori.
She say since her papa don gada heart to move on afta her mama die,make dem livam alone.
Although no famili memba dey prezent for di marage.
She say she dey busy naim make her no attend but she nor fit speak for di rest pipo on why dem nor attend.
Buhari and hin frends attend di marage.
Me and my frends also attend make e for nor loss.

ONE JOINBODI SIDON OF WEN PATO RANKING AND TIMI DAKOLO DEY SING 'ONLY JESUS CAN SAVE',DON SHOW FACE FOR INTANET


Dis guys must dey in high spirit as dem enta dat ginga mood.
Pato Ranking and Timi Dakolo and some oda pipo,giv respet to di son of God,Jesu Kristi as dem bigin sing "only Jesus can save" for one joinbodi sidon.
Guys,abeg make una join me Watcham for botom Hia..


Saturday, 16 July 2016

RITA DOMINIC DON YARN SAY,YOR RICHNESS NA FOR YOR POCKET BICOS HER LOVE NOR BE FOR SALE


Nollywood big name Rita Dominic, don yarn 'Hollywood London Magazin' say,she nor kia about any man money bicos she get her own.
She say she nor go bicos of any man richness put bodi for ground bicos her love nor be money for hand back for ground but true love.
She yarn say if yor pocket full dey troway sef,nor be bicos of am.
Akordin to Rita wey selibrate her 41 years betday some days ago,she say,she go only folow man bicos of love not bicos of di richness wey di man don gada.
Veri gud Rita.
I get one koret mesage for you.
Asosiashon of jobless youths say make I ask you weda you go gree marry dem even as dia pocket dey leak?
Dem say make I hep dem somit dia aplicashon.
No shishi,dem nor get shingbain,but dem sabi love pass Ramsey Noah.
U fit marry any of dem?
Dem dey wait for yor ansa.
Tank you.

Friday, 15 July 2016

MY PAPA GET SKILLS PASS OKOCHA--NA SO ANDRE AYEW OF GHANA TALK


Black stars of Ghana and Swansea of England playa,Andre Ayew,don yarn tori  pipo say,Jay Jay Okocha skills dey learn for wia hin papa skills dey.
Hin papa,Abedi Pele wey win di Africa Cup of Nations wit Ghana for 1982 and also win Champions league wit Olympic Marseille,na one of di best playas from Africa.
Now Ayew don come out to yarn say,Abedi get evritin pass Okocha and he dey more tactika and more skillful pass Okocha.
Although he say,e pain am say Jay Jay nor eva win di Africa futbola of Fire year award bifor he retire.
Even for Ghana,if dem vote for playa wey get skills pass for di world,Okocha go carry first.
Abedi Pele name nor go dey top five hundred.
Abi na back of TV Andre Ayew dey watch?
Abi nobodi don yarnam wetin world best playas and coaches like Arsene Wenger,Samuel Eto,Roger Milla,di real Pele of Brazil don yarn about Jay Jay?
Playa wey introduce hin own Motorola skill enta futbol!
If nor be say na one tin one tin,I for say na raw ogogoro wey Andre Ayew shack,naim dey givam eye ploblem.
Abeg Andre,try watch one of 'skills papa' vidio for bottom hia witout raw ogogoro for yor mouth.
Oya klikam....



Thursday, 14 July 2016

NOLLYWOOD STAR,MERCY AIGBE SAY,SHE DEY WEAR BUM SHORT MAKE ALL DIS TOOTHPICK LEG GIRLS NOR GO SNATCH HER HUSBAND


Dem say yor own na yor own o.
Anytin wey u go do to take protect yor own,nor waste time to do am.
Nollywood actress,Mercy Aigbe don yarn Tori pipo say,she dey wear bum short take denge for her hosband front make all dose toothpick leg gehs nor go snatch her hosband fromam.
Mercy Aigbe nor want any drama for her marage to avoid storis dat touch.
Mercy Aigbe make I giv you one advice.
Na now u goer buy more sexy bum shorts.
Yes o,diferen diferen wicked wicked bum shorts bicos,all dis gehs go won show u say yor bum short nor rish.
Dem go won use monkey sense take tempt yor hosband just like devil try evritin to tempt Jesus.
Now wey dem don know yor game plan,na for you to shine yor eyes welwel.


Wednesday, 13 July 2016

ORITSEFEMI DON USE GOD TAKE BEG NAIJA BOYS MAKE DEM ALLOW HIN DAUGHTA FINISH SECONDARY SCHOOL


Di double wahala singa,Oritsefemi,don dey beg all of una wey una eyes dey shook steadi say,her dota  go start secondary school anytime from now but make una allowram finish di skul jejeje.
Di bobo even dey beg say make dem forgivam for all di kukere waka wey hin waka.
All wetin he use Ajegunle gehs eyes take see dat time,he nor want make dem do am to hin dota.
Oritsefemi,e nor dey work like dat.
You get fast for 40 days and 40 nights.
Oritsefemi get two dotas wit een baby mama and na evriday hin forma babe dey swear foram bicos he brake her heart.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...