MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Thursday, 11 August 2016

E DON HAPPEN! 18 YEARS OLD OBAMA DAUGHTA DON JOIN "SMOKERS CLUB FOR AMERICA" AS DEM CATCH HER DEY SMOKE iGBO WIT BAD GANG



How long I won form good girl?
Na di queshon wey dey run for Malia Obama mind be dat as she don cut rope enta town just to show her true kolor.
Di 18 years old Obama daughta don join bad gang dey smoke igbo.
For inside dis vidio wey I put for hia,dem dey one groove dey dance but she dey busy dey smoke.
Now her papa nor fit open hin mouth to advice anybodi again bicos dem go telam say make he shut up since he nor fit train her daughta.
Now dis babe don put words for Donald Trump mouth.
Trump na her papa nomba one enimi and he dey contest for election to replace Barrack Obama as president later dis year.
Oya Klik and watch di vidio for bottom hia...


KENYA ASHAWO DON DESTROY DI CAR OF CUSTOMER WEY REFIUZ TO PAY HER





Congil na bastard!
Pray make e nor hold you espeshali di kain kongi wey go put u for ploblem.
If e try to get you,na how u fit take giam chance or manage di situation naim make u man.
Watch wetin dis Kenya okpongbo do to di car of di customer wey nor pay am.

Oya watch am hia...


Wednesday, 10 August 2016

JESSE JAGS DON YARN ALL MIUZISHANS SAY NOBODi AND NO BAGA SABI DO MIUZIK REACH HIM AND HIN BRODA M.I


Baddest rapperJesse Jagz don add boasting join him yarns as he don tell tori pipo say nobodi sabi rap and do miuzik reach him and him broda M.I.
Di rappa wey dey selibrate hin betday today yarn say,een nor kia wich family u come from,him and m.i combine togeda,nor get rival.

Tuesday, 9 August 2016

BUHARI NA F9 AND TOTAL FAILURE AKORDIN TO APC CHIEF,HUSSAINI MAIRIGA FOR KANO STATE


Chairman of one of di different joinbodi groups of APC wey dey for inside Kano,Hussaini Mairiga,don blast President Muhammadu Buhari as presido wey don fail for class.
He yarn Tori pipo say,di way wey tins be now,Buhari don fall evribodi hand wey soportam during di elections.
Mairiga yarn say nor be joke and film trick di way wey pipo dey shout of hunga for di kontri.
Di APC bobo say,many pipo nor dey even chop once a day bifor dem sleep for nite.
He also yarn say for dis one year wey Buhari don dey pawa,di poverty level for dis kontri don inkriz like mad.
Mairiga say bag of rice na 16k now and oda foodstuffs don inkriz like say dem swear for us.
Last last,he kon advice Buhari make he stop to disiv us say naija pulse don dry.
He say dat na big lie as we dey make plenti money evri month for dis kontri.
Yawa dey.

EVEN AS A A STRONG KRISTAIN NOW,IF DEM SAY MAKE I ACT ASHAWO PART FOR FILM,I GO STILL ACT AM-EUCHARIA ANUNOBI


Eucharia Anunobi di Nollywood actress wey don also turn to pastor,don yarn us say,she stil readi to act ashawo part for home vidio if dem say make she do am.
Wen dem ask her weda she fit stil accept ashawo script,she say yes of course.
One tin wey she say  she nor go do for di film na smoking bicos she nor dey smoke for real life.
She say she nor go also drink for di film if dem say make she drink but she fit act like who don drink 20 bottles.
Eucharia also yarn say she nor go wear close wey go show her breast or laps bicos she won act like ashawo.
Na wa o.

Monday, 8 August 2016

ACTOR JIDE KOSOKO SAY,HIM REGRET SAY HE MARRY PLENTi WIVES BUT NOW,HE DEY ADVICE HIN ENiMiS TO MARRY ONLY ONE WIFE


Nollywood actor,Jide Kosoko,don yarn say hin regret say he marry more dan one wife.
Oga Kosoko wey don loose three of hin wives to death say, him nor go advice even hin enimi to marry plenti wives.
Three of hin wives naim don die remain one.
Di last one sef go dey live in fear now but nor fear mama as God go kip all of us enta old age.
Di 62 years old Kosoko don get ova 12 shidren.

Sunday, 7 August 2016

IF YOU BILIEVE SAY I DON GO BACK TO PDP,NAiM BE SAY YOR MAMA NOR BE WOMAN-NA SO OBASANJO YARN


Forma khaki and sivilian presido,Olusegun Obasanjo,don yarn tori pipo say him nor dey go back to hin vomit.
Three days ago,rumors come out say Obasanjo attend PDP new komiti joinbodi.
But baba don come out to yarn us say,anybodi wey biliv dat stori,make di pesin also biliv say him mama nor be woman.
Obasanjo say wetin him go dat area go do na di invitation wey him get from Comodities Association Stakeholders wia he for put mouth join di 'Zero Hunger Naija' mata for di Shehu Musa Yar'adua senta.
He say he dey he own jejeje for Musa Yar'Adua Centre wen some PDP pipo come gritam.
If you rememba 18 months ago,baba tear hin PDP membaship card to pieces.
Akordin to OBJ dat time,he say di party don fall yakata and dem nor get direction.
He say wetin he tell di world last year be say,hin don quit 'bodi jam bodi' politiks and di quitting na final.
Baba say dem just wan fool am and make hin vex.
OBJ say dat time wey PDP dey united and dat time wey dem dey bubble wit life,him live dem,not to talk of now wey dem dey strogle to breathe and now wey dem dey divided like one minus one(1-1).
Baba pasona pesin for tori mata,Kehinde Akinyemi,naim sign dis baba tori.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...