MINIMEE NOODLES

MINIMEE NOODLES
OBEY YOUR HUNGER

Saturday, 5 November 2016

NA TO SERVE GOD NAIM SURE PASS,NO MORE SMOKING IGBO.. AKORDIN TO SINGA,RUNTOWN


Wen God dey see him shidren dey misbehave,di tin dey always dey pain am for bodi.
And wen you decide to savam,Baba God go just dey smile.
He go say Yes! my pikin don resiv sense.
One of naija finest miuzishan,Runtown,say him don stop to smoke igbo today as he won draw closer to God.
Who nor go nor know.
Bobos,ride on.
Na di way to go be dat.

Friday, 4 November 2016

YORUBA WOMAN, LOLO 1 OF WAZOBIA FM LAGOS,AFTA HER FIRST MARRIAGE CRASH DON TALK SAY,IF SHE GO RE-MARRY AT ALL AGAIN,NA IBO MAN SHE GO MARRY


Omotunde David a.k.a Lolo 1 of Wazobia fm,don talk say,na Igbo man naim she go like marry dis time around if she marry again afta her first marage crash like pack of cards.
Lolo wey don born four pikins alreadi,tell tori pipo say na Ibo man naim sure pass now for her life but she neva tell us wetin Yoruba men do her.

ONE ASHAWO BABE DON RELEASE Di NAKED FOTO OF EDO STATE PDP CHAIRMAN,DAN ORBIH,AFTA Di CHAIRMAN FAIL TO PAY HER AFTA DEM DO KEREWA



See gobe!
Dem Don turn krismas season to season of relizing naked foto and kerewa vidios.
Days afta some pipo reliz di vidio of Miss Anambra 2015,Chidinma Okeke wen she and her frend dey use cocumba do kerewa,one ashawo babe don vex reliz di naked foto of Edo state PDP chairman,Dan Orbih.
Akordin to di tori wey sama salt enta our backyard,di babe vex reliz di pishor afta di chairman fail to pay her money afta he don do kerewa finish.
Di babe say na wen di man dey snor naim she snap di foto.
You see our politishans?
Make we sidon dey wait wetin dis chairman go yarn for di one wey dey ground.

Thursday, 3 November 2016

AKORDiN TO TORi WEY DEY REACH OUR TABLE,SOME WORKERS DON DEY CELEBRATE DEY WAIT,AS DEM DEY HEAR SAY,OGA BUHARi WON iNKRiZ SALARY


If we say make we take di tori wey we dey hear take sirios,naim be say naija workas go soon smile as plans and meeting don start to inkriz dia salari.
We hear say Oga Buhari don ready to listin to cry wey workas dey cry since as dollar and price of tins  don go up.
Nigeria Labour Congress (NLC) bin don dey shout say na N56k dem want make be di lowest salari for workas from di 18k wey be di minimum wage right now.
Di meetings dem Don alreadi start.
So make we sidon dey watch wetin go appun.

Wednesday, 2 November 2016

E DEY PAIN ME SAY,I NOR MARRY BIFOR i COME POPULAR..NA SO KUKERE MASTER,IYANYA TALK


Iyanya don yarn tori pipo say,if him fit rewind evritin go back,he for prefer to marry bifor him dey popular.
Akordin to di kukere masta,wen you don popular,di mata go kon tie wrapa bicos now,him get miuzik and marage to tink about di same time.
Iyanya wey just sign for Mavin record,say if you say make you go church go find woman marry,you fit go end up to marry devil,if you say make you marry dancer you fit go marry trouble.
Evribodi wit wetin dey do am for bodi.

Tuesday, 1 November 2016

COMEDIAN GORDONS,DON USE STYLE YAB FORMA OGA MILITANT,ASARI DOKUBO SAY,SINCE BUHARI TURN PRESIDENT,ASARI NEVA MAKE ANY NOISE LIKE SAY DEM PADLOCK HIM MOUTH


Comedian Gordons don use style yab forma Niger-Delta militant oga,Asari Dokubo say since Buhari take ova pawa from Goodluck Jonathan last year,Asari bodi kon calm and he neva yarn anytin since like say dem padlock hin mouth.
Gordons yarn dis one as joke for one show for Port Harcourt.
If you rememba bifor di elections,Asari shout welwell say,if Oga Jona nor win,naija go turn upside down.
Since Buhari finalli win,Asari sef don run hide like say dem padlock 🔐 hin mouth troway di key for lagoon.

Monday, 31 October 2016

3 MONTHS AFTA HE LIVE MADE MEN MUSIC GROUP(MMMG), IYANYA DON JOIN DON JAZZY MUSIC COMPANY,MAVIN RECORDS


Just wen we tink say we neva hear of Don Jazzy for sometime now,di bobo don announce one ogbonge news as he take concern hin konpini,Mavins record.
He announce on top twita say Iyanya di forma co-owner of MMMG wit Franklin Ubi,don join Mavins record.
Wit dis one,Iyanya don join up wit Tiwa Savage,Korede Bello,Reekado Banks,D'Prince,Dr Sid,Dija as fellow workas for di konpini.

LinkWithin

Related Posts Plugin for WordPress, Blogger...